Anoda wik don land laik Marisa dance and l no say all of us ready gidigba for the instrument to play. But before dat time, make we at least use style take tank baba God for him love for us and de power wey him de use since to make sure say we no by awaself use awa hand take fall awa own hand. If l start to yan mow say no be many of us wey see las wik get beta luk to see dis wik own. Una go start to say na wetin l don de yan since geregedegbeun.

How una de and una family? Hope say de struggle for to survive neva turn ya brain into sawdust? All of us not say naija nor well and all of us too nor well? But as de mata take de so, we must to find a way to take survive every which way any of us find awaself, in it?

If una use una tongue to take cant una teerh, una go reason de mata wella from una side and cum see say de whole tin be as e get, abi? Dis mata wey l wan yan on so, na mata wey tie wrapper rand awa waist.

Befor l even start to yan laik cricket wey see wahala, make l quickly ask us wetin we no or sabi about film premiere and how e take good for us as film pipo. If una use adult eye take luk de mata wella, una go see say evri film person need to really undastand wetin dis film premiere mata mean. All of us no say today, any person wey even do small skit don arrange invitation card, pay for hall and get MC for de premiere of him new skit. Many pipo in de name of film don use style take turn film premiere into launching of dia film wey neva cum out. Me tink say, de whole mata get as e be sha. We need to really sidon luk dis mata wella and cum rison am so dat we all go den undastand how de mata take de.

As film pipo, premiere na wetin evri film pipo need to take run tins with dis film mata. Na area wia film pipo suppose use to take allow pipo luk dia film with eagle eye to see all de yamayama wey de inside de film and cum plan how to take correct dem. As many of us take no wetin film premiere mean, nobodi fit use am take do us anyhow. Film premiere na wetin we suppose gada join bodi to take helep us for awa tin.

Related News

Wetin l wan advase us, on dis premiere mata be say, as film pipo, make we de use style to take see premiere as wetin we nor fit do without. Make we see am like butter and bread, laik Agidi and akara, laik tongue and teeth. Make we de make film with awa mind on how we go take put am for premiere. Once all of us as film pipo don begin see film premiere as de backbone of awa film, naim be say we do jump ova awa wahala, as dat na de only way for de owner of de film to see de problem of de film and cum find solution to how to take solve am.

All of us no say no be small sometin e be to take do film. All of us also no say na Kuza i wey carri load laik hunchback dem take de do film na. All dis one no even de for de kuza to take organaz cinima or any oda areas wey konsan awa marketing of awa films. If una use adult eye take luk dis mata wella, una go see say, film pipo de try as dem power reach but true to God, dem need to try more joor. Any film person wey no plan for wetin go fit helep in anyway to take make de person film get level, show say de person neva readi die bizness.

For all of dose wey undastand wetin l de yan so about film premiere, must to learn new tins. No be say, film premiere go jus make ya film begin sell for cinima or any oda place as good film gat to do with beta story, beta actors, beta recording, beta editing, beta sound, beta light and beta color grading. All dis tins de among plenti tins wey de make films to sell wella and to also get followers. Who no go nor no.

As film pipo, e good say, all of us go de chest out to show to evribidi say we ready for any kasala wey wan begin make us to not rison tins as e suppose be.

If you wan make ya film get de feel of wetin you want from pipo, you gat carri pipo along na. Wetin premiere de do be say, pipo wey don gada plenti experience for film mata, go siddon luk de film and cum do dia kontribution for de film to make am swit wen eveibodi cum begin luk am. E go good wen we begin de see premiere as wia we fit do all de korections befor de public see am. If all of us as film pipo begin see premiere laik dat, tins go begin to de change, awa film industry go de grow and all of us go cum de make plenti kuza, afta all, kuza join wetin make all of us de use awa talent to take hustle. Las las all of us go learn new tins. But sha, make una no forget say, if we all no protect awa film industry, na oda pipo from oda states go cum de enjoy awa sweat. Anyways, we go see nex wik and yan more. Make una pray to baba God to keep us alive till we see again. Bye bye ooooo!!!