My pepo, make una no vex too much sake of say man pikin no fit nack una de tori as e dey hot last Friday. De rezin be say de tree wey dey dis side no let us see de one wey dey for de oda side. Na so life be. Nahim be say, de tin wey make baba no sow agbada dis year, de pikin go know by de time him grow up.

Anyway sha, we thank God say na so de mata be. De tin wey no fit kill man but chop money na gladness de end am. So diafour, una all go gada thank God for all Him mercies.

Dis day, tuke tuke driva go nack de tori wey him see since all de local gofment pepo enter their office. Sake of say make man pikin no talk long tori, we go put am for somari.

You see, some politishans really mean bizness while some na to look for how dem go share share money. Weda dem work or dem no work, dat one no koncine dem. Kpata kpata you no vote for am again, dat na if tru tru de vote wey him take win na pepos vote for am. Anybodi wey win eleshon for court na wayo winner him be. If you ask how, I go tell you but not now.

Na seven council dey for Edo South. Three soroud Oredo, de kapita. But out of dis seven, so far na only one don get pass mark for de kind work wey de Chair dey take him pepo do. Dis kome make us beleve say tru tru, de tin wey man dey do, woman go fit do am and even sef do am beta pass man. Wait! I know say you don alredi know where I dey go. Oya, make we gada sing dis sing, one, two, go! “If you see my mama, hosana, tell am say oh, I dey for Egor…”

Na beta tin dey show himself. Me I no surprise at all. Right from de time when we be Midwest Region, den Bendel and now Edo, de tins wey we still dey enjoy so, na our late uncle, Ogbemudia put all. Na stadium, abi na seketariat or television? Make you yourself dey menshon am.

So diafour, as I come hear say nahim pikin be de Chair for Egor, I no surprise again, like fada like pikin. Her work no be paper own, na propa akshon. Egor don get new face. My broda, make you find time take waka go see de gutter wey dey around Five Junshon, you go sabi de tin wey I dey yan. No be say she siddon office dey direct workers to go do job but she herself go wear apron, kari basket dey pack san san wey dey gutter throway for moto. No be only for Five Junshon but even sef around dat place wey dem dey call Tomline.

Bukuru pepo say cleanness nahim dey near Baba God. Egor Chair don dey take Egor pepo near God like play like play.

Anoda tin wey go make man nack award give dis mama na de kind way de revenu pepos dey take do their own work for Egor teritry. Dem no dey take stick nack moto or make dem dey porshu drivas sake of say dem one kolet money. E be like say de bus and taxi driva dem don even sabi de pepos way dem sopose buy ticket from. If the time wey dem dey buy ticket just rich, you go dey see driva dem dey blow horn to call the tiket seller dem make dem come kolet money. Sharperly, sharperly dem don comot. Even de driva dem wey dey come from Oredo don dey use to dis metod.

Related News

Up Chair!

Inside Uselu market plus de soranding neat die, you no go fit take am compel Oba market at all. And if you look de two, dem dey near council office. Oredo pepo no kukuma send.

Una don pass Upper Mission Road? At times man pikin de wonder if Oredo people de visit New Benin Market at all! Wetin all de health workers de do for all the council? Abi na only to dey waka for street dey check house wey no get latrine be the only work dem dey receive salary for?

De kind fly wey de tanda on top of de meat wey pepo dey buy near de dirty na oga. Dem no get pair and na diferent color dem kukuma get. Na for only New Benin Market you go see green, red, blue, and yellow fly.

Tru to God in heaven, e be like say disease no dey kill black man especially de ones wey be Nigerian. To put salt for sore, no be say Oredo pepo no dey see am but dem no just worry. Na so de show also be for Oba Market. By de time de fly don comot for de dirty, dem go find where dem go relax on top of de meat around. And na pepo go still buy de meat go cook for house. But for Egor Council Area, you no go see dis kind thing samsam. De time don reach wey de Oredo Council pepo sopose copy de way Egor Council pepo dey take operate.

I throway plenti oboku salute to Egor Chair plus inkludin de oga for tax collection office. Una do well. Make una continue una work as una dey do am jeje so. If nobody give una award, dose of us wey dey use tuke tuke take dey pass sabi say una dey try.

Three gbosa for Chair!

Three gbosa for HOD tax abi na revenu collection.

Make una no forget dat Tomline area bikos rain don dey come small small. De remova of sand inside all de gutter go helep well well. Let de new phase of Egor continue.