I jus rememba dat particular parable wey elderly pipo de yan us dose days. Dem de tell us dat time say if you no gada pawa take blow ya flute make e loud for evri pipo to hia, nobodi go invite you cum village square to cum blow flute for masquerade to take celebrate awa ancestors. Even awa Bible also yan say, who get sense no go balance arrange lantern, light matches on top am, after e de shine, we go cum go put am inside drum and use trail take cover am. No be darkness wey no de in hurry go cum hold family meeting with de person be dat?
Edo State pipo, wen e cum to anytin dem de use brain or talent to do na numba one and evribodi no dat. Awa film and many tins wey be say na to worri person brain to do, my pipo, jus liv am to Edo pipo. Wetin l de yan so not mean say pipo from oda states nor sabi use dem brain like Edo pipo oooo, wetin l mean be say, Edo pipo plenti for dat market as Delta State be too. Una still rememba wetin dem de call Bendel State pipo, wey be Edo and Delta States today, dat time? Dem de call us numba one for evri tins and na true. I no say many of una go don de wonda say wetin Tatafo wan yan again wey make am don de talk about Bendel State. My pipo, de Bendel wey l de yan about today so, bicos of indomie pikins dem, naim be Edo and Delta States wey many of dem cum meet from baba God as dem neva born many of dem dat time. Anyways, how una de? How preparashon for Bulaba pro max? Make una nor worri, awa cocoyam-hearts go see us through dis whole wahala.
Nor forget say, l start my yanings with any person wey nor blow him flute wella for awa ears to hia, nor go eva get invitation to cum blow him flute for awa ancestors to dance put. Na dis one make me wan ask awa Edo film pipo how dem wan take make de film bizness to bicom ogbonge bizness wey fit de contribute Kuza more dan de one e de contribute so far? Na how we go take turn Edo State to film lab wey evribodi both for Naija and Obodo oyinbo go wan to de cum invest ogbonge Kuza put for film bizness? Na how we fit even let pipo wey nor de inside Edo State even no how far Edo film industry bizness don reach? Na how we go fit promote all de ogbonge film tins wey we get for Edo State to both de film pipo inside and outside Edo State? If l wan begin ask quesions today, day go break l neva still finish to de ask.
De film pipo wey don ova enjoy de film labs for Edo State na even film pipo wey com from oda states. Dem go just sneak enta Edo State, enjoy all de tins to make dia films beta, clean dia mouths as if notin happen, and go back to dia difrent states. Dem nor de eva talk about awa Edo film lab, wey we de call CREATIVE HUB, wia anytin about pipo wey dia brains de hot for creative mata like film and plenty tins de shele. Make l shock una? No wahala. Una nor say many of awa Edo musishans like Rema, Shalipopi, Drill and many many ones plus awa Edo comedians don also do dem shows dia? Abi na pipo wey de sabi draw pipo wey dem de call Painters, Sculptures, or fashion, em em, wetin dem de call all dose pipo wey de do oshelenge with pipo clothes, and to show say dem fine with dia body like stick wey dem carve? (Abeg na joke oooo!!!) I don rememba, run-way models and beauty pageants. What about technology and many ogbonge trainings to take make sure say Edo State film industry get structure? As we de yan so, una even no say anoda program for pipo wey get talent die for stage productions wey konsan acting, dancing, singing plus cultural dancers from all ova Edo State? De name na ENINA THEATRE FESTIVAL, like small FESTAC of dose days, you go only know wetin FESTAC mean, if you belong to indomie generation. ENINA THEATRE FESTIVAL wey de start evri July to August na to make sure say awa pipo and awa indomie generation nor forget anytin about theatre and awa history. If una also take una mind back, una go also no say na Edo STATE INTERNATIONAL FILM FESTIVAL, one of de best for Africa, naim Edo State take de round up all de tins wey konsan creativity for de year.
Now, wetin awa film pipo don do to take make de world no say we de do all dis tins for inside Edo State evri year? Make all of us nor forget say we get many many social media platforms wey we fit de yan all dis many awuf for pipo wey get talents, why we from Edo State wey don even enjoy all dis awuf nor de yan about am for social network? As for me sha, l go advice de Edo State make him make compulsory for any entatainment person to sign paper to promote de creative hub for at least 3months for dia social media networks. We not fit de kolet from one place and no com de wan fill am back somehow. Like last year many of awa film pipo go luk for Kuza to take shoot film for EDO STATE INTERNATIONAL FILM FESTIVAL, and na so e suppose be. Even as l de yan so, Tatafo catch many film pipo wey de vidio dia film de wait de film festival. Na so e suppose be. Anytin wey nor get improvements mean say de tin nor de grow. So, to make anytin wey konsan film pipo grow mean say we all must to talk about dem. Film in Edo Project and Creative Hub de coordinate many tins wey konsan film pipo to make film vidio for awa state de easy like who de chop eba with ogbono. Anyways, l just say make use today take yan small on all dis mata like introduction before marriage. From nex wik, l go begin let una no wetin all de tins about Edo film industry, plus quesions wey l raise hia fit helep us wella to make Edo State kontinu to de for front for creative tins mata. Las las na all of us go gada wak de breakfast, but not forget to de blow de flute of all de goodies about film and creative bizness for awa Edo State.