I too like awa pipo wen e com to anytin wey wan resemble parable. Na for dia, we get pawa like pawa Mike of dos days. We ova love parable and not bie awa fault at all. If una even put eye for grand, una go also com see say, if no be condition wey make crayfish bend one kain, wetin konsan agbero with ova load? Anyways, wahala don enta inside town. Infact, wahala don go tanda for inside centre of market so dat evri bodi go see am. Na dis kain situweshon go make jornalis carve headline for newspaper like dis: Wahala Goes To Town. Who neva undastand go fear fear na.
Shebi una rememba, wen l de carri my fatti pen waka bout, de write plenti plenti tins, com de yan about how Gofnor Obaseki do dis and do dat, how him approve Edo State International Film Festival ESIFF, ENINA Theatre Festival, all de trainings for Creative Hub, film studio, film lodge and many many tins wey full grand so tey, oda states gofnors sef com shocktalize as dem de see and hia tins wey dem neva hia before. Some gofnors sef com use commando style style take send some of dia pipo come Benin City to com study how Obaseki take do all dis America wonda unda three years. Like play like play, many states com begin invest for de krietive industry as de tin de comot kuza like ritual kuza. If l say make l start to menshon states today, we not go liv dis place.
Anyways, de rison wey make me de rememba una all dis tins nor be jus for mouth oooo, na to let us come begin undastand de kain Kasala wey wan burst inside de krietive industry so. At least no be my mouth una go com hia say som pipo don de shoot pumpi since ova who go de kontro ringroad, new Benin, and many many areas for awa states. De mata strong and tough reach say, many many pipo don kpai for de mata as many don delete since sharperly. De mata be like wia full community de figh ova sharing formula on how dem wan divide one cow and who go first chose and why, if not why!
We get one oda parable wey yan say, if you wey get gold material, call am yeye, oda pipo go use pack dorti trowey. Which is to say diafor, na de kain value wey you place for somtin, go force oda pipo to use dat kain eye and value to luk am. I don de talk am since say, Sonja come Sonja go, barrack de remain gidigba. As Obaseki time as gofnor don end so, him no carri gofment house comot from Benin City or com put chains for all de tins wey him do and com drag dem follow bodi. Dis one show to us dat anytin wey any gofment use awa money take build na awa own property and we must to guide am with awa lives odawise pikins dem go grow and one day dem go ask us wetin we fit do to protect de tins wey gofment use tax payers and allocation kuza do for grand.
If l de hia from pipo mouth say, de new gofment no send de forma gofment, l go jus de laugh de drink my cold drink, de rison be say, no gofment de use dem personal kuza do anything. Na awa kuza dem de use, so why dem go want us to first dance kokoma to dem own song befor dem go use awa kuza for us? Na wetin gofment wey get sense meet for grand dem de work put and to improve so dat de pipo go see say dem de work wella. Dis new gofment get eye na, and no person wey de see wey nor fit like beta tins. So dia for, na awa duty as film and krietive pipo to gada awa sefs and see de gofnor and discuss as one family ova all de buildings and projects wey de grand and how to make dem even work pass as e be befor. Na to plan to advice dis gofment on why dem need to set up wetin oyinbo de call CREATIVE INDUSTRY BOARD wey go get pipo for de krietive industry as members.
I hope say una no say, de krietive industry nor be only all about film, e also involve stage production, bronze making, wood cariving, dances, music, sculpture, paintings, tourism, hospitality. Writing, etc. Na big industry for dos wey undastand de industry, una go also no say na Kuza spinning machine. Na all dis kain tins we as krietive pipo go jus trowey eye comot like say e nor konsan us? Whoosai! As de mata don de him de so, we all for inside de krietive must neva rest until dis gofment give us hope say dem nor go turn evri tin wey dem build for de krietive to church or ordinary offices for wetin nor konsan de krietives. Wetin dis gofment suppose involve we wey de inside dis krietive industry for na how to explain to dem on how we fit monetize our krietive industry now. Monetize mean how to begin make beta kuza from the krietive industry bizness so dat any tin wey we kriet, we fit get beta way to take sell am to pipo for awa state, other states and all ova de world, jus as Netflix de do with only films and televishon. I do. First menshon IGODO MOTION PICTURES for one of awa tori dem. I go need to settle down and explanate am and how e go fit help film pipo to begin get wia to de make dia own kuza as pipo de make from Netflix. Anyways, dat na tori for anoda day. Until den, no eva let Bulaba pro max make you fall for inside gutter….