My pipo, l wan welcome us to anoda ogbonge week, bcos, me l know say, kpakpa, our hustle must to pay. We no fit just de carry loose guard when we no say baba God gat our side na. Dat is to say, na we by awaself invite family problem come awa parlor be dat.

Dis week don set for us wella be dat as long as we no fail in awa hustle. Una still rememba wetin bible tell us about say, baba God must to bless de labour wey we take awa hand do? If una rememba, naim be say, we suppose no wetin come de delay awa blessings from baba God, abi no be so?

Dat now bring us to de topic for today wey concern de hustle wey baba God must to bless for us and as filmmakers plus pipo wey de act for films and write de tory wey actor de act, so dat we go de happy to de do more. Make we no forget say all talents na from baba God, and if we no gree use de talent as him want us to use am, him go take am from us and give am to dose we need am pass dog wey de expect big bone.

I no say una go de wonder wetin l wan talk or weda l don turn pastor as l de mention baba God plus bible since l start dis gist. Make una relax bcos tory jabrata, so no worry like who wan go Warri or come let inpatient de wire your mind like who de wire-road. Beta gist de and e concen as actors de nack directors plus producers of film to fit get role to come act for film. My broda and sista, de mata tire me wella. Infact my hand even come weak pass over ripe dodo wey soak oil for inside hot oil pot.

As correct tatafo guru, naim l use style like who wan catch rat for inside native pot withou breaking de pot, to find out who de nack who plus who be de nacka and de nackee. My leg almost turn to rubber wen l come see say de wahala na from both de nacka and de nackee. See as ya eyes de roll for ya head like sughusughu (owl) and ya ears tanda like bat own wey de find signal to fit gbese from wahala. True true, both de nacka and de nackee de as guilty as charge, which is to say, so- dia-for, if both of dem land for court over nacking mata, court judge go nack hammer against dem.

Do you no say, some female actors na real badoo? Tatafo find out afta plenty gist dat some of dis female actors wey don kolo pass who de on kolos, even de nack PA (production assistant) so dat dem fit connect dem to de director and producer of de film wey dem do audition for. All na to get and secure dem roles and nothing more.

Related News

Dis one no be kolomenta so? How baba God go bless you with fine face and shape, beta yansh, correct man-chester, brain wey arrange wella to spoke beta English, you still kukuma come abandon all dis God’s gift to come turn free-area de share and nack everi bodi to get role? Dis your own problem no be follow-come home problem wey village people gada put hand so?

I no wan shake table like who take kolos, make una no come de use one kain eye like pussycat wey wan tif fish take de look me. Reason why be say, our girls need to put padlock for dia dross. No be everi tin dem must remove dross to get, odawise, one de monkey go go market and e no go return back again. See all de fine and ugly girls wey de occupy beta office, many use dia brain instead of nacking everi tin to get to de top.

Make l no lie sha, l don see and many filmmakers, l mean the men, don raise hand for many girls for dis our film industry wey use iron take sew dross. Some of dem even come get name like holy Mary, akagum, and plenty plenty funny names like dat becos why be say, dem no gree draw dross down for any role wey director or producer wan give dem. Many of dis kain girls wey suppose to become role model to all of de girls, don come be like smelling sore wey flies de follow as dia co-girls de call dem local girls, mugu, and plenty plenty funny names like dat.

I no say many of una de wait to see weda na only de girls mata for nacking for roles l only wan talk, whosai! Nacking mata na virus wey don affect everi wia to de point say, World Health Organization suppose create and recommend waist-mask for everi bodi for our industry. Wetin self, dis no be juju? Me l no still undastand why Director or producer trousers go de pump like water-pumping machine anytime dem see girls for dia audition wey come compete for roles for dia films. Werin self? Dem do una? Na wia dem de get de mind and power to tell de girls say, “You ready to nack me for role?” Pipo get mind sha, dem get mind reach to put ring-boiler for river to hit reach to make eba.

Our men really need to zip dia trousers wella if na dat place dem problem de with girls. Dis film nackists suppose use dem tongue to count dia teeth to no say audition na interview and no be ashawo joint wia to carry olosho even though all of us don no say many ashawo don run come join de act for films to come use am take help dem olosho hustle. All dis kind wahala no go help develop our film industry if we all no let professionalism control our dross, as many beta pipo wey suppose carry our culture throughout de world go run comot becos dem no wan nack. Make we still fear God and at least respect our dross so dat las las we all go fit chop breakfast without wahala. Nacking go be everi tin my pipo. Fly wey no wan hia word naim de follow deadbodi enta grave. Una do ooooo!!!