I don land again and na to first nack una happy happy new year. Las las make we for nor lost, today mata tie wrapper round for area wey concern our film bizness and how we wan fit take do am make e work wella for all of us.

Make una nor forget say na 2023 just use kurukere style take waka pass us so like tortoise wey de on mission. Anyways, my quesion now be say, wetin we don fit achieve inside de year and na wetin be our plan for the new year 2024? You de squeeze face or you de search ya mind for answer? Anyways, as sharp man with sound mind, when yawa gas, na to begin find solution instead of to begin cry over milk wey don pour for grand. Make l come back to my quesion; Wetin be ya achievement as actor or pipo wey de work gidigba behind de camera?

To use cross-mind begin nack de nail with our big hammer, you must to gazo de reason why we all as pipo wey de do de bizness to make pipo laff must siddon, look wetin we don do last year, know where we make plenty mistakes and wetin cause de mistakes for us.

Yawa for no de for dis mata, if we fit use our tongue take count our teeth, but where yawa must to gas na wen after ya tongue don see de teeth wey loss and yet you use de tongue waka pass am.

From January to ember months, de journey no well for many pipo. Many pipo see pepper as dem struggle to survive; weda as bizness man, as dose wey de for gofment and even many pikins dem wey nor get work. All of us no wetin our bodi pass through and all of us hear am wella as our bodi fone us. All of us eyes see better atarodo pepper and de ones wey fit open dem eyes small to see road quick quick japa leave us.

My pipo, de wahala no be for only nija as even obodo contris self feel de tsunami wey nack dem economy too. We wey de for de film bizness and de do cultural dance or act for stage and even de sing, we suppose know where de heavy rain for start to beat us so dat we go also know wen de sun or breeze come begin to dry our cloth. If we no use our sense and sharperly prepare for 2024, na nicodemus be day oooo!!!

We wey de for de art bizness wey oyinbo de call creative industry must siddon write our plans for dis year, like for example: wen we wan take go do our film, how we wan take get de script and actors, plus de houses where we wan to shoot de film. I no say you go wan ask say how you wan take get Kuza to take run am. You never hear wetin oyinbo de call contract? If you no know abeg quick quick Ben Jonson go find out ooooo! As for dose wey gazo wetin I de yan, abeg arrange de contract to make de pipo wey wan work for you to trust you and use dem full belle take work for you.

Related News

Base on logistics, no go do pass ya self bcos say you don put dem hand for paper, you go wan come use hunger take wire dem belle for ya location bcos say dem put hand for paper. Next time you no go see anybodi wey go wan break neck for you as na wetin you plant for farm now you go pluck tomoro. Na de same tactics dose wey de do musik fit still do with de owner of de studio wey de dem mind to use. For all dis mata, get am for belle say disappointment fit tie wrapper for ya waist or kpakpa even for ya neck, but no ever give up as 2024 must to work for us by fire or thunder.

Make una always get am for mind say all fingers no de equal as all our face and inside belle no be de same. Wetin dis mean be say, wetin work for Nosa fit cause kasala for Otas. To gbese from tory dat touch de heart, make you for nor come bite ya finger with regret, you must shine ya eyes wella so dat no opportunity fit gbese pass you.

Oyinbo de talk am say time no de wait for person and since na so life don come be, we too no go let de time leave our side. If na to kidnap time kidnap am oooo!!! We must cross-mind to fit take get result for everything we put our hand for dis 2024. To blow big time easy, but na to not say we must prepare our bodi and mind for de work wey de follow to blow.

As pipo wey de do film, make we no find excus for our laziness inside dis 2024. Any which way, we must find way. If your film nor fit enta Netflix, what about Africa Magic, Urban, Prime, Showmax or even YouTube? If all dis wan wan delay you, why you no go arrange premiere and invite ya family, friends and association members? My own be say e beta make you do something dan say you not do anything at all.

We must to fight any yawa wey wan gas for our side oooo! If we not fit stop de yawa from gasing, make we jump am pass. Una nor why? WE MUST BLOW any which way inside dis 2024. Get am for mind say, God don already punish devil for you wella, so make you stand gidigba and waka like egbe-wager wey wan go kolet aza from mugu.

I nor say many pipo go say weda no be person wey don do film fit carry go Netflix and even YouTube? True true, na true you talk, but why you nor first cross-mind find person or persons to join una kuza togeda to do one beta film? Na dis one oyinbo de call collabo. All l not be say we all must blow inside dis 2024 come-what-may!

Oga, e get as things go take de for ya side plus wetin go come happen to you, pipo go begin blame you before dem ask quesion. So diafor, make una use una head wella to avoid wahala wey fit become kasala for your side. Any way, before l forget, HAPPY NEW YEAR to all of una!