Many pipo de wey no fit do without say dem no go watch film for inside cinema by dem sef, with dem friends or with dem family.

Some pipo de ask wetin de make pipo de gada money wait every weekend for cinema mata? Some even talk kpakpa say you need to come see how dis pipo dem body go come begin shake like barber chair once weekend de reach.

My broda and sista, we get parable wey say if you no because of panded yam chop soup, you go because of soup chop panded yam,which mean say una must begin reason am to come de go cinema to watch film or to make the film industry grow gidigba from where it de as at now.

If una remenba, una go still know say dis cinema mata no just begin start today. It have tey when cinema don begin hold ground for nija. When oyinbos dem de rule us, dem like cinema as Benin pipo like unripe plantain with Owo soup, or Esan pipo like panded yam with ogbono soup. No be lie na, but as de oyinbos dem like cinema dat time, we de use corner corner eye de look dem as we de try to understand wetin dem de enjoy for the cinema mata. Na so we begin reason am till dem give us independence and vamoose.

Afta dem oyinbo pipo comot, naim de Lebanese pipo come bring de cinema wahala come again but dis time, come begin show Chinese karat films like Bruce Lee, war films, and cowboy films plus many ones dat time. Chai! I still de remenba films like Enta de dragon and Wide Wide West.

My quesion now be say, true true dis cinema mata don really helep our film industry at all? Without nodding dat head like agama lizard wey survive dat fall from dat long tree, de answer na big YES! I no say many pipo go say how many pipo de get time to go watch film for cinema but again dem no make cinema for spirits na. We get dat parable wey say if dem neva sack you from Leventis, you no go nor say work jabrata for Biwak.

Related News

Home video don make many of us come begin tink say cinema na waste of time. No be lie na, because all of us don de used to just go video centre dat time to buy video dvd, siddon for parlor cross our legs and begin to watch our films one by one. We fit even pause am wen we like and begin to watch dem from where we stop,but make l let una know say home video time don turn waka-pass as na cinema time we don land put again now with many things wey de for every cinema building to take make the time wey we wan take watch film no tire us and our family. Many get yanfu yanfu games wey children fit take de jolly and na so many chop chop de for dem plus for adults.

Pipo wey de do de film bizness suppose don gather togeda to plan how dem fit build small small cinema for different areas so dat dose wey de Agbor park area or different by-pass no need to come de wahala on how dem wan take find money to buy fuel or transport dem selves to Ugbowo, Tv road Sapele road areas befor dem fit watch film. That one be as e get back na as dat alone fit make pipo change dem mind and use de money take arrange sweet-mouth for him family and dat one don automatically become minus one for de film industry be dat.

Wetin me de tink for my mind no be all dose big big cinema wey the money to build fit make who no get dat kind money be like who juju deceive to use him own hand take invite heart attack. Film pipo fit build small cinema for all dose kain areas wey fit carry like 50 to 100 pipo at once to watch film. Una know say wetin suppose fine wella always de come in small size. Once dis small small cinema wey oyinbo dem de call community cinema, don land these far far area, de community go come develop as oda tins wey de follow dat kain crowd go also come de communities. Once security, like vigilantes plus police know say dat kain cinema de dat area plus say beta understanding de between the community and cinema owner for one hand and de security pipo, mata don by himself blend wella be dat. Afta all, na who no like beta tins?

Na the wey nija come take de come make us know say tins don be as e get. Dia for, evry bodi don turn tailor as we de measure everitin we de do now. Money no easy to see nawadays as everiwia come kakaraka. Nobodi wan be him broda keeper again as ever I one don turn aka gum. Dis no mean say we go becos of say contri don hard come make us no de do Wetin de give us joy and fit make us live longer. Make we de save for every weekend so dat we fit jollificate for cinema as person wey neva marry or as family man. Cinema na wia you fit also make new friends, meet new bizness pipo and learn new tins from de films you come watch.

No go be like case of monkey de work but na de baboon de chop. Everi tins for life na plan. So my pipo make we de plan enjoyment for awaself becos if we no do, am nobodi go com do am for us. All of us no say life no reach six o’clock again, so dia for, we must to de manage am de go becos na who de life de game. 2024 don de old and na so all of us go begin work like jaki to pay all our bills, without any plan of jolification for awaself. Before you open ya eyes pipo don begin shout anoda happy new year. Make cinema one area you fit go de rest for weekend Afta you don work like jaki throughout. Na brain and bodi wey rest wella for weekend de smart for work de following week. A word, as oyinbo talk am, is enough for who ear no de pain. We go see next week to reason togeda again. Make l go chop nkwobi before l enta de cinema wey de near me.