My pepo, una gud morning. When some pepo go dey talk say dis world don change I no dey gree at all bikos na dis place wey Ikpoba River dey de time wey dem born me, na there e still dey. I know say this Ring Road wey tanda for center of Benin City so, na public field we dey call am. Dat time dem dey come dey show us John Wayne Cinema for free. Even kpakpa we don dey see aboki wit melu melu plus dagar. Everybody dey mind him own jejeje. De only aboki we dey fear dat time na de one wey dem day call gbomo gbomo. Weda na tru or not na dis kind aboki dem say dem dey tiff small small pikins put inside de big bag wey dey don carry follow body.

Mens and womens also dey get dada for head. But dem no plenty as e be today. Even de ones wey dey get dis dada so, our papa and mama tell us say na so Baba God take make dem come dis world. We even know say na bikos of de juju way dem bring come from heaven make their hair be like dat. Dem also tell us dat time say even if person no get dada from heaven, dat breeze wey dey sweep ground fit carry dem go inside forest where dem go stay put for many many years. By the time dem comot from bush, their head go come produce dada.

All of dis na to make pepo believe say dem fit do any kind juju for person. Some dey even tie tie cowries and bead for de dada.

Anoda kind pepo wey we dey see dat time wit dada na de pepo wey their head don nock engine. Jos like de juju pepo, razor blade no dey toch dia head.

So therefore, dada no be de tin wey new at all at all. De new tin be say pepo don dey use their hair do dada by fire by fire. Up till today, origina dada still dey but na fake dada plenty pass. Wetin hapun wey our pikins wey be boy come dey like crase person hairstyle? Even sef those pepo wey get juju dada don yamutu plus say many don troway de juju come face God for church. Our boys dey para, dem no wan send!

Why person go like make him dey look like person wey him head no correct? Dis tin dey pain me well well like say dem press pin for my skin.

De time wey we dey grow up, barber go ask you de kind style wey you wan barb. Dat time we get sugar baby, police haircut, Afro and the Beatles. De same things with de kind trouser and shirt.

Pikins of dis time dey call dat kind dress old skool. Now, dem no dey put belt for their trouser again. Dem go take one hand hold their trouser, take the other hand dey press phone as dem dey waka for road. If you see de pant wey some of dem wear, boy-boy wey dey learn mechanic no fit wear am bikos of de kind dirty wey de pant dirty.

Haba! De show never finish ooh. De trouser sef go tear tear. Weda na dem dey tear am or na so dem dey buy am, man pikin no fit talk. Man no sure say na e tear like dat before dem buy am.

Related News

Na dis kind tin wey make police dey give pepo like dis double wahala sake of say na de time wey Yahoo boys take arrive all dis yeye dressing start.

As for de girls, their mata don pass be careful. How rape go take yamutu when na de girls dey even provoke de boys? If fifty girls waka pass you, na only about two go fit bend down pick her money if it by mistake fall down. Bekos wetin dem wear too short.

Make you hear de tory wey tru tru hapun for dis Benin not too long ago. As me and my mama sit down for front of our house, three young girls dey waka pass. All of dem wear very short skirts. I nor know say Mama dey look dem. By de time dem come closer, dem greet us. Mama call one of them, de other two follow am. By de time dem don come close, Mama tell am say make she help am bring one stone wey dey for ground for am. Oturugbeke! Wahala don shele! As she bend down to take de stone, she dey struggle to use de other hand cover her bum bum with difikuty. Na so my mama come tell am make she rise up. She also tell am make she go home go change de dress wey she wear. De girl surprise me. She thank Mama, turn back go wear anoda dress. By de time she dey come back, Mama call am again, pray for am, advice am not to be wearing such cloth, come give her some gift for obeying her.

How many girls do dat kind tin? Instead she go pour out abusive words for de old woman.

De Edo chapter abi na verse of National Youth Council of Nigeria (NYCN) get plenty work to do. Agree say any person fit do wetin him like so far as him no come do am for your bodi, but nor forget say na de place wey your own human rite stop na there anoda man own begin. Somebodi talk say to be a crase person be good if not for de waka waka wey dey inside.

We dey shout say no job, how person wey get sense go fit take person wey dey dress like crase man put for work?
Oga Youth Council chair, make you put dis mata join your agenda for Edo Youths, I beg.

Benin people dey talk am say na de cloth wey you wear dey attract courtesy. If you take by mistake wear trouser wey tear tear without belt plus your fake dada go your in-law house for a visit, make you no vex if him ask you make you helep am break firewood. Na de way you take present yourself to am.

My pikins of dis generation, we gada beg una make una stop dis madness in practice. If una must kopi pepo, make una dey kopi de tins wey go make pepo happy and move forward like dose small small oyibo pikins wey sabi how to do computer so. Dressing like mad pepos no be de way at all.
Una doooh.