I just de vex like vesper and no de happi like pipo wey balablu jam like trailer wey jam tuketuke. Dis na nonsense na, shuooo!!! Person go chop leave rice cum chop de leaves join bcos the rice and stew sweet? Fa fa fa…, fowl! Make l no cum vex forget to greet una wella becos inside dis evian wey all of us de so, anoda evian don cum de inside. Awa prayer be say, make bulaba nor do over sabi cum join balablu put Cameroon pepper for inside awa eyes…, Amen. How una de? As long as you de fit still chop any wia you see food, show say baba God neva remov hand for ya bodi. May 6feet no fit close de Usain Bolt space we don give am…, Amen!!!

I no say many of us don hia, don cry, don write RIP, don even tink many tins wey fit give person BP. My pipo, dat na normal tin to reason like dat, wen person wey we nor or wey be celebrity kpai or just carry delete like dat. All of us don hia say one veri popula celebrity wey him name be Mr. JOHN IKECHUKWU OKAFOR, aka Mr. Ibu, Uncle Wayward don kpai Afta him no only sick, but cum lost him leg thru operation to save him life, befor bros Cardiac cum grip am and kukuma delete am. All of us nor say de mata get as e bi bcos, e get some kain wahala or family problem wey go jam person and him nor go wan pray make dat kain tin jam him enemies, but again, na so life take de gidigba.

If una luk dis mata with adult eyes, una go join me to belif say him kind of kpai-ing na wetin de happen to many pipo since even befor dem born us, but wen e happen to celebrity, de mata go be like say e neva happen befor. Kpai na kpai and him no get respect for any person wen him wan strike. Abi we don forget how Mr. Kpai take delete the Oga of one big bank and still delete him wife plus him small pikin with odas inside helecopta for oyinbo land yonda?

So dia for, plenti tins de wey we need to de tink of and to also do, but l no say e easy to talk dan to do, but again na so life take de him de. Weda you be celebrity or not, if you still get chance to put ya house in oda, abeg do am befor ya family wey you tink say de unite, go de tear ya pant for public. And wetin pain pass for inside be say, everi bodi like to hia bad news pass good news. Na de tearing of ya pant dem go carri for head. Na dat time you go nor say, you no even nor de history of ya pant & even de real value.

My pipo, nor wait till sickness give you uppercut or tie-neck befor you go wan cum reason wetin you suppose do, odawise my pipo, water go just de pass ya garri like tsunami wey use anoyance give any countri headbut. Socia media don turn papa and mama plus ticha to awa pikins dem bcos, pikins de spend more time on internet pass time with dia parents or ticha all in de name of l wan use internet do awa assignment.

Related News

Parents for inside toilet, bathroom, motor, church, mosque, traditional house, working place, for main road hold dia fone de look internet. Dem even de buy fone for 2 yias old pikin to de luk so dat make him no cry or disturb dem. Na dia wahala de start to enta market go dance like masquerade for everi bodi to see. I nor say una hia how Mr. Ibu pikins and wife dem de give each oda tie-neck for internet wen de bros de hospital bed de struggle to rasole with Mr. Kpai. If una reason de mata wella, dem nor do wetin dem do bcos dem hate Mr. Ibu, but na wetin distance from each oda heart de cause be dat. I no mean say dem no de stay for de same house or village oooo!!! Wetin l mean na de kain distance wey de between two pipo wey sidon with each oda, but de give dia best attention to dia fone. Even if de person wey near dem kpai, dem nor go no until de batry of dia fone off. Shebi you undastand wetin l mean?

No be say l de yan say internet or fone bad, but make we not let am take de position of papa and mama, family plus ticha position. If we fit get awa time-table for internet wey nor go disturb awa role as parents or ticha from wen pikin small till wen him or her don reach 18 yias, internet nor go fit catch de pikins dem and give dem evalastin tie-neck. Even for some church, na fone be dia bible. Dis kain tin be as e get na. From small small clapping of plenti hands naim dance from de start.

If we as normal pipo wey not be celebrity be like dis with awa pikins and internet, na wetin you wan expect from pikins of celebrities? If una rememba, befor internet cum de, na many rich pipo pikins and pastors own no de behave well as dia parents always de travel for bizness, crusades and cum liv dia duties as parents to dia house girls and house boys. Tell me, how anoda person wan take train ya pikin pass you? Befor dem go say na community naim get pikins, and true true, dat one work with poor pipo but not rich pipo wey de slap and arrest ticha wey discipline dia pikins for skool.

Celebrity nor be moimoi and na so to be good papa and mama nor still be moimoi. If una want make life beta for everi bodi, nor liv ya pikins for only ticha, houseboy or house girl, internet to train for you. If you too go marry internet like ya wife and everi bodi arand you, naim be say internet go train de pikins dem for us and wen dis happen, na to cum de say “I nor be like dis wen l small, Luger respect wen l small for my elders” and so on, but na internet or houseboy and housegirl train you? If we nor replace de sawdust inside awa heads now with sense, las las awa pikins go teach us wetin internet don train dem to be. If you like pretend say you nor undastand wetin l de talk and cum even de tell me say if not for internet, de world nor go be global village or technology for neva grow…. No wahala my pipo, las las all of us go learn. Make una refuse to kpai oooo, so dat we all go de happi to continue to de yan on plenti tins we fit beta awa lives. I celebrate una gidigba like who de enjoy breeze under tree inside rock-chair.