One thing wey me I know say person no fit run komot for na to die or yamutu. Die no know big man abi poor man. Die na die and fit come anytime.

Some pepos dey talk say die get difference – good die and bad die. If you ask me say wetin abi which die be good die and which one be bad die, na de same question me ask de person wey talk say na two abi three different die dey for dis world. But na one type wey get plenty metod better pass bikos for everything for dis world, one dey better pass de other.

By de way, which kind die you wan make you die?

Make you no rush to put ansa for dis kuestion till de mata finish. Put am for your mind say one day, you go die till our broda, Jesus, go come back wake all of us so dat we go follow am go enjoy for Heavun, de place wey die no get power. Make we leave dat mata for Matayas.

We dey hear say pepo dey comit de tin wey dem dey call suiside, de die wey pesin dey take him hand do by himself sake of say this life don tire am. Did kind pepo dey tie rope for neck after dem don put am for tree den jump comot so dat de rope go tite dem neck. From dat show, dem go yamutu. Some go even jump enter de river wey deep well wey dem know say dem no go fit comot. Even sef, some dey put “otapiapia” for their food chop am. All dis na one style wey pepo dey call suiside. Other boku metod dey sha. As for man pikin dis kind die no be beta die. Anoda one wey pepos dey do na to take knife shook for dia belle so dat before pepo run come save dem, die don take am.

De thing wey dey surprise me for dis kain pepo be say, dem dey see trailer wey carry rod and cement for road but fear of this same die wey dem dey look for no dey make dem jump for de front of de trailer. Pesin wey true true say him wan die no sopose fear. Na dis kain die dem dey call bad die. One man wey we see for Ring Road last time talk say de rezin wey him come Ring Road be say him dey look for beta moto wey go kill am, but no be de kain moto wey Dangote dey take carry cement. De kain moto wey him wan make him follow die na like dat moto wey big mens dey drive so dat him go fit enter grave with complete body. Him talk say if trailer helep am die, na shovel dem go take scrape him body for tar road. Dis also na bad die. Make we cut de mata, which one come be good die wey pepo suppose to dey die since no how, no how, man pikin must die one day bikos all of us no go fit die de same day?

Na here de mata come get kay leg. Na for dis junsion gofment con enter de mata. Weda we like am or not, everybodi know say we must yamutu but dis time, na gofment dey take wayo wayo bring die for pepos, especially for dis our Naija. Dis na de rezin why pepo dey run comot “jakpa” go anoda country wey die dey sweet. For inside dis Naija, na pepo wey die dey enjoy pass pepo wey dey alive. De kain kasket wey dem dey put pepos wey die and de kain moto dem dey take carry de kasket na wa. If you see how pepo dey take make yanga with dead body, true true, to die go dey hungry some pepo.

Make you find time go near de family of dis person wey die so, you go surprise say when dis man dey for life, shishi him no get from hin pepo. De room wey hin dey stay before him die no even get bed not to talk of chair. De dead man sef and de kain moto dem put hin kasket no get any tin wey join dem togeda for dis world. If you go near dis family, wetin you go find out say kill de person no pass hungry and de money wey hin no see take buy merecine when hin dey sick. De kind gofment wey we get na only their pocket dem dey look. House, electric, food, water, hospito no be de tins wey poor pepo fit get for here. Why person no go die?

De numba of people wey no get house plenty pass de ones wey manage build by far. How person go fit build house when one bag of cement don bekom fourteen thousand naira? Sand no join. Na only de pepo wey dey do pen robber for gofment dey fit build house now. On top of dis mata, house rent don dey go up every two-two monts.

Related News

Man pikin upon all these wahala no go even fit sleep for dey house sake of say light no dey to see road not to talk of use de fan wey dem buy about fifteen years ago when tins beta small. Where de money go from come to buy fan as tins be now?

Yesterday, one man and one woman bin wan fight bikos of say de man price one paint rubber of garri for one thousand five hundred. Kuorel start when de woman tell de man say make hin go farm so dat him go dey sell hin own garri for one-five. Garri wey be poor man food bifor don bekom rich man food. One paint rubber dey cost two thousand plus; by now, it fit don rich three k.

Anoda wahala now be say water don go thirty naira for one sachet. If no be gofment wey no wan poor man to drink water, wetin consine poor man with sachet water if public pump full everywhere as e be before? Big mens get borehole so therefore weda poor man drink water or dem no drink water, dat na dia hedake.

Dis day, na only poor pepos malaria dey kill bikos hospito no dey give merecine to pepos again apart from say dokita fit tell you de kind merecine wey you go buy.

All dees wahala no rich wey person go start to dey think of de kind die wey him go die. Hungry fit make man pikin sleep and him no go wake up de next day bikos e fit be say dat hungry don pass two days. Person fit decide to die sake of say fear of landlord no go make am come house since him no fit pay house rent for de pass three months.

Na for dis same Naija papa and mama decide to sell two of de children wey dem born so dat dey fit get money to buy food for de other pikins make hunger no kill all of dem.

Moto wey one big man dey drive take by mistake jam one boy and de boy die. The oga go meet de papa make him no vex but dat him go give am five hundred thousand naira to take do de needful for de burial. De papa shaperly collect de money and asked de man where him park him moto put. De oga ask why him wan know de place him park him moto. De man, de papa of de boy wey die, beg de oga say him still get two children. Him want make de oga also take style jam dem so dat him go bring anoda money make him take do their burial.

Wit all these things wey you don hear plus de one wey you don know, which kain die you go like to die? Remember say every die na die. If you ask me, na who me go ask?