Anoda day don land like eba with ogbono inside awa belle, but inside dis evian so, anoda Evian de inside. If you no you no but if you nor still no, any which way, you must still cum no. Nor be wetin person get him fit give out to anoda person? Abi you don see person wey de work for Dangote cement company cum go de receive him salary for NEPA? Fafafa…,fawol! De reason be say, if e nor de e can’t de, which is to say, nor start wetin you nor fit finish odawise, de matter fit over you, in it?

Anyway, make I not go let my blood hit me reach wia l go cum forget to ask una how una de and how una de survive de balablu condition wia all of us cum find awa selves, like fishes wey turn sardine inside kpangolo? We must to no say as de matter de now, na all of us de inside dis evian and e go helep us all, if we cum no say anoda evian de inside dis evian wey we all fit take survive wella. Las las, my pipo, l hope una don chop?

Na wetin nor go make de pipo wey de make us de happy everi time and still fit de smile small small, no cum tire for dia work to kontinu to de do dem work without cum de suffring and smiling as hot tears of bad bizness de run comot from awa eyes like Ikpoba river. Make you reason dis mata na; you sell ya land, or borrow kuza to take go do film and to get de kuza back cum be like you put ring boiler for river make e hot so dat him fit make eba. Reason am my pipo, no be to kpai from hunger be dat? Abi not be wia person for de work him suppose de work? If na lie l de talk or wetin l de yan no enta line, make you reason me.

Una don reason am say, most of dis pipo wey de video actors for film, de always de yan about BIG FILM for pipo ear? Una neva hia wen dem go de call some kain Kuza wey be budget for some Africa country? If you cum fit gada mind ask dem say, wetin dem wan use de kuza do, you go de hia tins like, “I wan use dis kuza shoot de big film for Netflix”, an if las las dem nor cum get de right connect or fit meet de tins wey Netflix wan see for dia movies, dem go cum be like person wey dem naked for inside market. Dis tin l de yan so, like say na noma tin, don make many film pipo kpai, some broke, some cum de on de run, some lose dem properties plus plenti plenti wahala wey tie wrapper.

Wen awa elders, wey don shuk hand inside rabbit mouth for inside dia hole, de talk from experience, we all need to listen if we no wan face de same kasala like dem. All of us by now suppose don no say, experience no be biabia, and dem nor de see am to buy for market. Wen pipo wey don fall for inside hole de talk, we wey still neva fall inside suppose to learn. Nor be oyinbo pipo talk am say, any person wey de do de same mistake and de expect to get difrent result, don kolo be dat?

Related News

Make una nor get me wrong ooooo!!! I no talk say e bad to take risk like blind man wey wan jump big gutter, or dat to gada kuza to shoot for Netflix bad. Whosai! Everi tin about awa life na risk na! Even for wota and food to pass awa trote na risk na. Abi we all go cum reason am say bcos river delete sombodi, make we not de go river to baff or draw wota?

Wetin l de yan be say, before you go cum borrow kuza, add ya pikins skool fis plus ya house rent join…, my broda! Make you reason am wella, make e not cum be say na ya beria cerimoni we go cum chop naija jollof ooooo!!! Netflix bam no doubt, but if ya Kuza no reach to shoot ya film or you no get beta infomate about how dem de take operate, just kukuma go shoot film for YouTube, African Magic, Urban and plenti plenti platforms wey full everiwia. Must you cum and kpai ya self by ya self for noting?

If una reason am, no big man wey go borrow kuza from bank go take start bizness wey him nor no. Abeg if you no any, make you let me no. If e like make de big man no go skool, him must to ask plenti quesions about de bizness even up to say, hope him go still fit get him kuza back if de bizness fall yakata for ground. My pipo, l use baba God take beg una, especially dose wey wan use anoda person kuza take do film, to teslo small and ask beta quesions before him go enta dis film bizness to do film. If you tink say to use two legs with ya eyes open to check weda river deep na tori, no wahala. Oyinbo say experience na de best tisha.

Las las, my pipo, no bizness bad and film be like who wan go put kuza for oil well bizness. You must to no how much kuza e go chop, which pipo you go use, if de hole una dig, oil nor de, una go still get kuza to kontinu? Wen you fit ansa dis questions and many more, naim be say l no go fit liv de ansa for my opponent to ansa. Make you stay gidigba till we see nex week, as baba God nor go let pipo cant us join pipo wey delete. I salute una.