I no say many pipo go don de reason me wella and even de wonder why l de always tank baba God for heleping us to jump six feet pass without scratching awa bodi. Una tink say easy like using akpu to collabo okro soup for daret jorney to awa belle? See my pipo, if baba God put dis world for television for una to see how many pipo kpai from only las wik till dis morning, una go fear fear walahi. Especially wen you come reason how dem take kpai or wetin delete dem like wia eziza de use dust do pojupoju rand pipo house befor e uproot am like cocoyam.

So dia for, de normal tin to do like dis na to always tank baba God say we nor only sleep and wake up, but also fit miau pass dis balablue breeze wey de blow like eziza for evriwia and cum fit sidon to arrange ya self to de read an follow Tatafo evriwia e de go like awa network. My pipo, hope una gallant and don chop? If yes, we tank baba God, if not, nor worri, who nor get today, must to get tomoro, in it?

Tatafo don de worri like fowl wey don big to chop for chrismas, not because de fowl de fear to kpai but e nor just wan kpai. If una open una okpolo eyes and cum shine dem wella to look dis awa film pipo, una go see say many of dem de act film for us bcos inside many belle be like toilet wey nor gree flush. I no say some of una don turn una big head de roll una eyes like sughusughu say wetin dis Tatafo de yan, abi him de on kolos? Anyways, dat na una wahala, but my quesion be say, how many of una wey don eda use Osusu money or una life savings do film and cum de smile go bank? Ok na, atink una brain don de connect like fone and charger? No worri, l go explain more as we de go, bcos no bizness man de happy to put kuza wey him don hustle for inside pocket wey get big hole.

Una rememba dat time wen we de do film and cum de sell am for VHS cassette? Ok na, see as una face don de bright small small. Una still rememba wen de bizness cum improve enta CD and later DVD? Oyes na, all of una must to rememba bcos na dat time uppi Iweka de rain, Idumota and Alaba de boom not to talk about the many film hosale centa wey full evriwia from Yorubaland, Hausaland, to Edo/Delta. Chai! Dat time you need to see as naija de boom for dis bizness sotey, pipo wey nor fit buy cassette, CD or DVD go just go rent from video club. Pipo wey de for de chain of de film bizness den na from the film pipo like cast and crew, marketer as dem de call dem dat time, pipo wey get printing press to de design and print film jaket and even television and radio stations. Evribodi de happy dat time from de film producer, executive film producer to the pipo wey de watch film. Dat time so, cinema don kaput bcos na video we cum de do instead of de kain ones we first de do like oyinbo own for celluloid wey dem fit de show for cinema dat time.

Related News

If una look am wella, una go reason am say, de first time wen cinema first boom, television neva de, so wen television cum land, pipo nor cum de save to go watch film for cinema as wetin dem de wan find go Sokoto de inside dia shokoto. Na so, like play like play cinema and celluloid cum becum oldskool. Dis tori na for anoda day, so dat l fit konsetrate for wetin l de yan. To do film or video nawadays no be moimoi, bcos many tins de involve like kuza and how you wan take get de kuza back plus ya profit. So na how to get ya kuza and profit back, na dia de koko de. Many pipo don open YouTube, some de enjoy am while many still de see am as wilywily bcos dem neva still fit see shishi wey wash from dia YouTube channels. Some don even de worri evribidi for internet de beg say “go watch my YouTube channel in de name of God make l for still remain for bizness”. If you nor undastand why dem de beg you, just imagine say you go borrow kuza like 5mita take shoot film, nak am for YouTube and cum de luk for over 1million pipo to watch am befor you fit breath from de leg wey who you borrow money from put for ya neck. Dat one no be to kpai?

Tank God say cinema don cum back again and pipo don de cash out from it, but if you not do beta film you no fit cash out. Dis not be like say, you don buy cassette, CD or DVD and no fit return am. If ya film no make sense for cinema as e be today, to no fit cash out wella like India or America cinema bcos, awa cinema neva plenti reach. E get wia awa cinema go plenti reach, if you shoot film wey just de say “how wa you? Thank you for wey you take cum cinema cum watch dis rubbish” and cum put am for like only 2million cinema for only 1k par person, how much you tink say be dat? Dis one no mean say make you go do yeye film oooo! I only just use am as example for film wey bad wella and wey pipo watch once before dem convince oda pipo not to watch am. Also imagine if de film na avrage or beta film wey las for cinema for only one month?

Una don de breath wella now abi? My pipo, if you wan do filmat all, and you no for ya mind say, you wan get ya kuza back from de small cinema we get as at now for naija, l use ya papa and mama plus God or anytin you de serve beg you to just do am well. Apart from say you go make kuza for cinema, no forget say many big big online film distributors don full evriwia and more de cum. De only tin dem want from you na film wey no only sweet, but wey de sound good to hia, de pishur no pain eyes, das all. No go use anoda person or even ya kuza take go do emababa oooo!!! Na heart attack you de invite to cum do rasomania for ya heart be dat and if dat one happen, na kpai de follow am afta account turn zero and cum de bance like bancing ball.

Befor you by ya self hustle kuza to take do any film, go show de tori to cinema operator make him read am advice you weda de tori go sell or not. Dem ask question about equipment and pipo wey sabi use am, and las las no go use Ogboju eye to take say you wan direct am bcos you like make pipo de call you “able D”. Film na bizness nawadays and no be emababa odawise na inside cupbod de film land and sleep put ooooo!!! Who get ear make him hia. Who no still get ear, make him still hia. We go see nex wik as l hope say, with dis few point of mine, l no konfux you but konvins you say, film na bizness and not emababa…, tank you.