One song wey just de play for inside my head so na, one song from Hotel De Jordan wey say: “Kokori de cry over Jordan….” I don de cry since and l no say many of us also de cry bcos, de kain tin wey happen so too de pain. May baba God give us strong mind to luk and remeba him good works dan him delete.

If to say who don kpai or who dem delete fit get only one chance to cum back to laif again, many pipo for just vex like Old Rojer rezuret, carry pump action begin de delete everi person arand dem. We too wiked or kpakpa too selfish reach to off oda pipo light make awa own for cum de shine wella. If you nor belif me, make you look arand you and tell me wetin you de see? From gofment wey take over from anoda gofment, na to no complit de fomal gofment work wey don almost finish go start to de lay for 200 story building wey him too nor go fit finish.

I de vex. Weda you don chop or neva chop no just konsan for dis one as de mata of pipo wey use dia church mind take serve awa fada land de kpai without love or kaidness from pipo wey dem serve and make proud. Una even no say many project wey Fomal Militry gofnor Samuel Ogbemudia use gofment money start stay for abandonment cum turn ancestor?

I de vex. Awa mind just dark as awa skin be. Luk all awa sport pipo, wen dem de rain laik new motor wey person buy, na so awa bodi go just de shake eda laik baber chair or agwangiri bicycle, but make dem comot for market laik uncle Benz rice, everi bodi go benjonsin liv am laik dem de abandon old pipo for village. Why we wiked laik dis? Dis mata l de yan so don cum becum awa kolshor wey we de worship laik pastor wey wan give him members holy komunion drink.

Dis kain abandonment don buga enta film and musik industry, and Edo State own naim worse pass. Well, maybe l fit no koret becos, Edo na State and anything wey happen, all of us de eda see am or hia am. No be say to kpai na curse or problem, na de way de kpai-ing take shele de make us worry. How pipo or person wey de give you joy wen you get stress, go cum de pass through stress and all of us go just waka de pass laik dat pastor wey nor helep dat person wey jam kasala but suffry dodge am and las las na one good man from one village wey dem de call Samaria cum helep am? Dat tory de inside Bible, to let you no say wahala nor de ever finish.

If una remeba Hotel De Jordan wey NTA de show dose days of black and white television, naim be say una must to remeba de song wey e take de start:

“Poor man de suffer

Monkey de work

Related News

Baboon de chop…”

Nobodi go hia dis song wey nor go run laik benjonson go sidon for front of television, dat na if ya papa get. Odawise, na to chigum one corner for window from outside to begin watch as Chief Ajax de give him servants, Kokori, Idemudia wahala. Abi na Casino Manager with Usiobaifo and Bigilar? Wat about de Bob Allan wey be jornalis wey no de ever mind him bizness? De tory of Hotel De Jordan no de ever end if Pastor Ewurujakpor, native dokta Okhue or Geregedegbenhu, Captain Nnamani, Corporal Uwa, Dokta Milomoron mata neva make Lord Mayor to start to shout “Bai Joe!”. I no say some of una wan start to ask of Chief Igho, Brafa, Gbenmwan plus odas. Shebi una see say all dis names for Hotel De Jordan get dia way to take make you laff and de happy?

Na all dis actors film pipo de call carakta for dia film and all dis carakta get as dem de take difrent from each oda and to also make you laik dem one kain. If una luk all de Hotel De Jordan caraktas, na wish one you not go remeba? All dis carakta and de tory plus de person wey produce and direct am na one person wey many of us nor no him name until many of us cum begin join pipo wey de do film so. If de man waka enta any place, many pipo nor no am bcos him no sabi make noise and no laik wahala. Na to write scripts and begin create caraktas wey go make sense to de pipo wey wan watch him drama him de always tink about. Dis man na koret drama and film magician. Him name na Pa Jonathan Ihonde. All dis tins l de yan about am so, nor be for am to get award or say him win jackpot but to let us no say de man wey make all of us de happy for many years don delete at de age of 87. Awa ogbonge Oga for dis film drama bizness kpai inside dis month as in say, awa epa don yamutu and go dai kingdom.

Him mata pain me wella as all de time l take de go see am for him foma house befor him enta anoda of him house wey near road, na so so scripts him de write plus books wey many of us fit take no him own style of how to write ogbonge script and to get de koret carakta for film or drama. Inside all dis yanings so, him be still get hope to use him magic for film as na baba for television drama naim him be, but as him nor fit get sponsora bcos de ones wey get de kuza nor no say naim be de brain wey de behind Hotel De Jordan.

Pa Ihonde na koret paddyman wey nor de pose for anybodi even doh you be small pikin or adult. Him nor also care weda you go skool or not. Him nor de waste time to turn tisha and tell you tory about how to do television drama. Now my kwesion now be say, how many pipo learn from Pa Ihonde? Afta him retire, how many pipo visit am Afta him retaya? How many film pipo even no him house apart from very few pipo? Make una no misundastand me ooo!!! I no talk say na una kpai am Afta all, wen him wife delete for him oda house, how many pipo go grit am?

If una mention Hotel De Jordan, gofment pipo no am but how many of dem no Pa Jonathan Ihonde? How many gofment pipo honor am or invite am to cum teach pipo him magic of how him take do Hotel De Jordan? Infact, how many film pipo or gofment giv am award wen him de alife? Anyways him don delete now, so na berial him family go de plan now. I go advise say make film pipo and gofment try to be part of him berial and also find how to take de remeba am. If na to create award on him name wey dem de give film pipo or pipo wey de expert for dem bizness, dat go give odas hope say if pipo and gofment nor remeba you now, dem fit remeba you Afta you don kpai and delete from dis world.

Pa Ihonde deleting pain me and many pipo wella, but wetin we fit do apart from to say make him soul rest well well? Him don do him best and do am gidigba. Na for all of us to use him own take learn say, wen life overtake you, pipo go forget you until you kpai or don delete. Make six feet far from us so dat we all go jollificate again by dis time next week. May bulaba far from you and ya family….