My pipo, another wik don land and na to first tank baba God say all of us see dis wik and nobodi carri waka, delete or kpai. If you think say wetin l de yan so, na easy sometin, go any mortuary and ask dem how many pipo kpai for only dis wik wey jus pass so, and you go shock to no say many pipo don drop and don join dia ancestors by force. For me and you to de yan laik dis so, show say awa moon neva off and baba God no go let awa moon off before awa time oooo!!!

E get sometin wey de worri my belle for some time now, and l no say de mata fit also de wind ya belle too as time nor day again for us on plenti mata laik dis. I take ma time to take find out why America and Europe dem film de laik say na from heaven baba God arrange am cum for dem. From wetin l use ma kro kro eyes see for dia buk wey l read, show say dem gofment use all dem bodi take helep dem start de film bizness from de scratch cum reach wia dem de so. Dem film and dia gofment be laik Owo and oghede, and una no say na wen dis hand wash de oda hand naim e go clean.

Wat about awa own film bizness? Na how e take start? Na wetin even make us tink of de film bizness self? We even no why we de do de film bizness? All dis quesion be as e get since to answer dem go mean say, de journey go long laik Mungo Park own. I want make we first no say Oyinbo dem siddon reason wetin dem fit use film take achieve wey go work wella for dem. The first tin dem do na to use film take change awa brain so dat we not go de reason well or even laik awa selves and wetin we as Africans de do. Na de beginnings of awa wahala as Africans be dat but de beginning of achieving awa soul by de Oyinbo pipo as dis arrangement work wella for dem.

I nor no weda de person wey discover de film and camera reason how pipo fit use am take change pipo minds, but if e de among wetin dem reason, naim be say over try de worri dem. Wen Oyinbo dem don see de magic wey film fit do to pipo, dem nor waste time at all. Dem jus land Africa and begin de show us films wey de show say Oyinbo people get brain pass us, strong pass us and beta for war with dem soja pass us. Afta dat, dem begin us film to kolet and achieve awa land, thrones and eve awa soul. I no mean say, film na evil tin oooo!! If una luk de mata wella una go reason am say, dem succeed bcos dem gofment see de film as dia weapon to capture awa minds.

Related News

Dia gofment support dem reach say, na dia gofment de sponsor dia film, and also de run film festival. Till today, dia gofment still de dash dia film pipo money to take de do film every time dem wan do film. All dis show say gofment hand nor fit comot for film mata for any kontri wey ready to move forward. Now wen you luk as how Oyinbo dem take start dia films cum reach wia dem de now, you go see say na wetin dem don plan since. Na how awa own take start? If una reason am, una go see say na by mistake. So if we say awa film na “born by mistake”, na true. If you no belif me na ya toro.

Una rememba wetin happen wen de Oyinbo pipo wan comot and how dem cum use hury hury take liv dia film unit wey dem de call Colonia Film Unit for us? If yan rememba, wetin happen? NOTHING. Naija only jus change de name to “Nigeria Film Unit”, and if una use adult eye luk am, na dat tin wey Oyinbo take twist awa brain cum end up as Nigeria Television Authority, NTA. I hope una still de follow my tori? Jus imagine wetin Oyinbo use take change awa brain, reach say we begin call awa tradition juju, cum troway awa native cloth plus native food for Oyinbo cloth, food and kpakpa carri dia language join, naim don turn to ordinary television house.

Why awa gofment nor fit use de film unit take also achieve tins from de Oyinbo pipo? Dis one show to us say, if e not be panadol e can’t fit to be panadol. Wetin you nor undastand, if e reach ya hand, e go be laik pikin wey hold herbalist leave for hand cum de call am vegetable. Nor be de pikin fault. Na wia him brain no reach be dat. Today, we go see America film de konvince us say de kontri gallant die. So tay, dem fit kpai for dem kontri. If you luk all Oyinbo dem film, na to de make us belif say e go even hard Angel Michael to defeat dem for war. But me and you not say, all dat one na packaging. Wetin we don fit achieve with awa film apart from to show say we as Naija pipo wiked die? If we no use person do ritual, we go show say awa girls na ashawo, awa boys na yahoo yahoo. Na bad bad tins we de show to de outside world about awa sef.

Dis tin l de yan so, show say we nor siddon as gofment and film pipo to find ansa to de question l first ask before about wetin make us start film. No be say e don late sha, as time still de gidigba. Gofment need to cross mind give film pipo plenti Kuza to take shoot film wey go show de beauty of awa culture, awa food, awa good hearts and awa good environment and make dis films free to de dominate awa cinema, also make laik Netflix platforms for dat Kain films wey go de liv Naija. Many tins de wey gofment fit use film take achieve, if dem ready to re-package Naija and Nigerians. Na dat kain free money Oyinbo de call grants plus many ways to take make film pipo de put Naija first for any film dem de do. Make l yan una de truth: if gofment nor put hand for dis film mata laik America and Europe do, na films wey go de make us hate each oda we go de do Everi time and las las na we go de lose both for local and international . If una laik waka pass wetin l de yan so laik the tori of dat man wey jump and pass dat man wey dem kponse for Bible before dat bros from Samaria cum save am, na hia l go still de and kontinu to de write until my ink finish. Anyways we go align next wik. Make una no do bad tin oooo!!!