I don land again but as usual, na always with tori. My pipo, how una de? Shebi una get time to jolificate de Estar wey just pass? Many pipo celebrate de Estar in difrent styles but above dem all, we thank baba God say many of us wey use mouth shout happy Estar, jolificate am, still gallant reach today to join us for awa new wik tori. Like my friend wey me and am start college dos days for Edokpolor Grammar School, Eugene Asemota, no fit make am with us. Las las na baba God alone no why. Inside all dis Evian so, l say make him soul and many laik am wey nor see dis weekend, rest in perfect peace plus say make dia family fit quick arrange dia minds for movement ahead. Na so life reach. Notin more.

Sometin de wey de laik push me to wan shake de table, but my fia be say men wey dia minds de back don break all the table legs finish. Now yan me, to let me no, na which table l wan shake him leg? Anyways, me nor ready to carry las for dis mata. The reason of de reason be say, pipo de fit break de table leg bcos of wia dem for break de table leg, and wetin dem take break am. If you neva undastand my yanings yet, naim be say l need to show you de map to de issue. Any time you de watch film for cenema or for ya house with pipo, you de feel laik to blame yasef and even come ask yasef quesion join say, na wetin make you siddon with dis pipo insted of you to by yasef watch de film alone?

Me l no send anybodi as e don tey brokotor, wey me don de apply “l nor gree for anybodi”. If l wan to watch any film, na only me becos person nor fit cum use him reggae spoil my Obito music…. Wat cause dat? For some cenema, bet9ja and viewing centas better pass dem. Pipo go wan use talk talk plus quesions take change ya destiny as if to say, na you get de film or na ya relations or friend get de films.

I de good mood one time and cum enkorage mysef cum cenema to watch film wey dat actor wey don delete but act wakanda de. Na dia my wahala for start. As dem jus show de man naim one man and anoda woman attack me. De first one nack my hand and say, “why you allow dat man die laik dat?” Instanta l jus loss bearing laik agbegi wey break fail. I gada mind as l don de vex cum ask am, “who, me?” De man nor shake at all as him ansa me sharp sharp, “yes na, abi nor be ya hand l nak jus na?” Dis time so, my belle don be laik wia motorsaw wey nor sharp de cut iroko tree. I nor jus waste time as l giv am raps from my mouth wotowoto as l ask am, “bros, de man luk laik my relation, or dem yan you say na de same village we from cum? Na wetin konsan agbero with overload?” De man konfuse and de tin sweet my belle laik gudigudi. I cum bend my neck small to make am be laik say na ogbonge attitude l wan release join wetin l first talk, but whoosai, de woman wey dis unexpected yanings no konsan just wik my legs like rubber band wey fall inside fire. She jus pose ask me say, “if de bros nor ask you, na vulcanizer him go ask? No be una de do all dis films? If film sweet we de worry una? Not be wen una do film wey de worry person belle we de ask una quesion? Common wetin kpai una actor, you don de misyan…, abegi!” Anyways, na so l no take watch de film l pay money com watch plus say l still buy big miniral with guguru wey l cum jolificate for road as l de trek go back my house.

Make una nor misyan me for dis mata wey l jus explain small so. De mata no be about me and de pipo wey get dat argue. I wan make una, as film pipo undastand say pipo wey de watch film belif say all of us no awaself die like awa teeth for awa mouth. Na so dem also belif say film na wetin de actors jus de do without script and plenty oda tins. Dis one also mean to say, dat as film pipo, we all must to de work togeda as pipo wey de watch awa film only belif say na all of us gada get all de films for cenema.

Una fit no undastand as film pipo as some of una go de buga say you de do film for moon and dose wey de do film for my village nor konsan you. Nor worry, jus de play. One day you go siddon for my sit for inside cenema for naija, Obodo oyinbo or China and wen dem ask you dis kain quesion for anoda way, you go start to explain and explain but las las with not evidence as de pipo go de tink say you de jus carri yan Balablu or bulaba. As for me, l tank God say, de ones wey ask me quesions nor carri hammer follow bodi, how you go take de sure of ya own???