Today, man pikin wan beg everybody wey read dis atiko make dem explanate to me de tin wey dem dey call KRIME and de persin wey dey do de KRIME. Wetin persin go do wey dem fit hold dem say dem don do krime wey dem kach dem put? Dis question dey very good to ansa sake of say de way our olokpa take dey do when dem see pepos wey get dada for head too much.

We don talk am bifor say dis pikins wey we get nowadays no dey hear word at all, but dat no mean say olokpa pepos go just dey open ATM mashin for dia head. Haba! For dis obodo kingdom wey king na tru tru king if even na grand grand papa city, if you like call am ashient town, na you sabi, olokpa pepos go comot eye for de tins wey dem say make dem dey do, go dey porshu de ones wey gofment no send dem.

One oga talk say krime na something wey bad wey gofment say make persin no do and if you do am, olokpa go gbab you. De persin fit go ayoko city becos of dat.

For ezampo, if persin tif, do kidnap, amu robry, take anoda man wife by kunni-kunni plus including putin fire for anoda persin property, na him dem dey call krime and de persin wey do am na him dey dey call KRIMENA. Gbam. Since time Imo River, man never hear say de kind klot abi moto wey persin buy na krime.

Today, as man pikin dey talk una dis tory so, boku olokpa dey do patro for town. No be say dem dey look for tif pepos, de rezin wey make dem dey do dis patrol na to find pepos wey get dada for head.

Plenty plenty times, dis olokpa wey dey do dis kind show nor dey wear olokpa klot. Dem no dey kari olokpa moto. Na kabu-kabu motos dem dey use. Dem fit kach bus driver say make him kari dem waka, especially when de driver don do one rong tin. No be say dem go even pay de driver afta dem don finis de waka wey dem use am take do. Anyhow, na diferent tory for anoda day.

Dis tory of de wahala wey dem dey give pepo wey get dada wan three much. De trouble go born turkey if de persin wey dem kach get moto wey dem dey call Camuri or Lezus. For dis ashient city, olokpa pepos no dey take eye see dis kind moto at all make dem throway face.

De mumet dem site dem, de first thing wey dem dey do na to say make dem park for one side. Afta dat one, everybody wey dey inside de moto musto come out. Olokpa wey no even know how moto papers be go dey shout make dem bring de patikulas of de moto. De next wahala na to kolet de telefones wey dem hold, up to the laputup. Before you know de tin wey dey hapun, dem don stat to dey negoshiate de money wey dem go kolet. Even if de dada pepo gree say make dem kari dem go for olokpa office, dem go take kunni-kunni put fear for de dada pepo bodi.

De olokpa pepo no dey take small money oooh. Na tousan tousan dem dey kolet. If de dada pepo no get kash for hand, olokpa go say make dem do transfer or kari dem go witdraw from POS wey dey arand de area. Even sef, plenty olokpa dey kari POS mashin follow bodi when dem dey go hunt for dis kind pepos. De rezin wey make dem dey do so be say, akordin to one olokpa wey we sabi, na dis kind pepos be de Yahoo Yahoo boys. Dem belive say dem get plenty money, so therefor, dem too must take dem share for de money wey dem take from oyibo pepos.

Who come be tif abi Yahoo Yahoo boys, or de olokpa wey also kari gun dey take operate for koro koro aftunu? Wetin koncine olokpa with telefon and laputup? Bicos de telefon wey dis boys kari dear well well, some olokpa go even ceez de fone from dem plus inkludin laputup. After later, dem go dey look for who go follow dem buy dem as kago.

Not too tay ago, na dis kin tin bring wahala for olokpa dem when one of de branch of olokpa wey dem dey call SARS come do pass demsefs sotay dis same pepo dem dey call Yahoo boys come organize show dem pepe. Yet dem never still learn any lesson.

As de country be so wey all de pepos dey vex sake of say hungry dey mama persin, who dey die dey die sake of say no money to take buy merecin, worker dey fear to come house afta him don klose from work make ogalanlord no see am, farmer no fit go farm make aboki no go take am do suya, driver no fit pay skool fix bikos petro too cost to take work, nahin some pepos bikos dem put de klot wey we gada sow for dem for bodi go still come dey take wayo and force dey obtain pepo pikins?

We hear bifor say de oga kpata-kpata for olokpa pepos don anounce say make olokpa no dey kolet fone and laputup from pepo again. Dem no wan hear.

Yanga dey slip, turobo dey take idea find am. De day wey boys go gada again say dem don taya for all dis wayo OBT, everybody go hear am.

You see, NTA pepo dey talk something wey dey make us dey try informate oga of olokpa wey dey dis kingdom about de tins wey him men dey do. NTA dem say, “If you see something, say something.” We don dey see, so therefore we don dey also dey say something. Make pepos wey get ear dey hear.

Ofone! Ka chineke mezie okwu’. Oba ghato Okpere, Ise!!!