Anytime wey man pikin wake up for morning, de first tin wey him sopose do na to tell Baba God “Thank You”, sake of say him don fit see anoda day. If you dey tink say na bikos of de money wey you get for bank abi na bikos of de position wey you dey for office make you dey still brit free of charge, na him be say you be state mugu. Bible even talk am say e go even eazy for head of lama lama to pass de eye of needle than for rich bobo to enter heaven. Dis na true talk.

Make una wait first. How many of una go fit talk de ezat time wey sleep take catch am for night? Abi de ezat time wey him take wake up for morning? Plenti pepo jus dey kari waka without thinking of how to say tank you Baba God.

E be like some pepo wey no dey drink tea abi milk unless dem dey sick. Yes, we know say milk don dey dear but before nko?

De rezin for dis talk dis morning na bikos of de tins wey man pikin see last week for inside hospital ward. At times, e good make pesin dey visit hospital make you know how God dey helep you.

Now, bifor we kontinu, make you tank God for your life – the way Him dey save you, plus the way Him plan to take save you tumoro.

May God hear our prayers in our broda name, Jesus Christ. Amen, Amen and Amen ooooh.

Politiks nahim be de numba one mata for dis our Edo State now. Pepo don start to dey do dis kurukere waka so dat dem go get notice me agenda. Even dose wey no even get voters card don dey nack dia chest to make sure say de big Ogas for de party wey dem dey support go notice dem. The new name for dis Ogas don bekom “My Leader”.

No be only one party dis dey hapun ooh! Na all de party wey get kandidate wey dey kontes for Govunor. Dem don dey reach like nine pesins wey wan do Govunor for our state. Even kpakpa, dem fit don pass nine. E be like say INEC been talk say na 17 pesins. But dat one no mean say we no know de ones wey serious sha.

Today, we go take our maikroscope look like three of de party.

Pepo don dey gossip too much about de politikal mathematiks, sorry, arithmetik of some of de kandidates. Some pepo also dey vex sake of say dem no gree make dia pesin kontes for dis election. One tin wey we know be say outgoing Govunor Godwin Obaseki talk am say weda rain dey fall or sun dey shine, de next Govunor for dis our Edo State go come from Edo Central. Dats why PDP come bring the man wey sabi – Asue Ighodalo – come out.

Hmmm. E be like say APC too take style join dat arrangee of Obaseki. Uptil now, man pikin no fit talk de rezin why Pastor Ize-Iyamu talk say him don step down. But we dey hear say Osho Baba dey inside de mata. So, Oga Okpebholo come be kandidate.

Only Labour Party still stand gidigba with kandidate from Edo South. Na from dis table de arithmetik of Edo politiks start.

PDP and APC go do tug of war for Edo Central bikos de two pepos wey dey kontes for dia party na from there. Dem be heavyweight champions. Sometimes PDP don plan say if dem no fit get high percent for there, dem go cover de gap with de vote from Edo South. Dats why dem quick quick bring Osarodion Ogie as Deputy Govunor. Well done, but… E be like say APC dey more comfortable for dia own arithmetik. The Deputy na from Edo South and Osho Baba, Edo North. Who go fill de gap for PDP for Edo North?

Make una no forget say de pesin wey dem beat, una no go tell am say make him no cry. Na only if we wan deceive oursef we go talk say Shaibu factor na yawa. Dat na big lie. So, if Osho Baba and Shaibu gang up against PDP, na him be say nothing go come to dem from dat angle while three kandidates go divide Edo South among themselves.

Oyibo pepo dey talk say for inside rumour wey dey shelle, small true go dey inside. PDP get too many mata wey dem need to sharperly settle and time no dey like dat. If election finish and de result no clear well well, na him be say judiciary go enter de mata. De Naija of today no fit guarantee de tins wey we go hear from tribunal. Dis our obodo Naija where tifi-tifi dankoriko afta tiffing our money in billions go run go hide for inside government house; country wey snake dey fit open iron safe go swallow money but e no go touch de papers wey dey inside de files; country wey INEC dey call election result for night; in long, country of all kind of wonders, anything dey fit hapun.

Make we talk true, e no even be like say dem wan do election for dis our state at all. De only time you dey remember say election dey come for next September na when you jam go-slow for some kind area. Dat na de time wey you go remember say election dey come.

Pepo no be as dem dey do before. Dis na bikos of say pepo no get confidens for election mata again. Dis na bikos, before dem even start to dey vote, de result don already reach INEC, so no need to go vote at all.

Our Govunor Godwin Obaseki get plenti boku issues to resolve. Make Oga no tink say de road to Evbuotubu dey smooth. Fa fa fa, fawul! Dat tree wey fall down dat day don get plenti holes, dats why plenti ants dey build skyscraper for inside.

By de way, de Oracle dey asleep?