If una laik, go fall mogu, las las guyman go wak for ya head. Dis yannings fit enta ya ears nor stay and cum leak comot pass de oda ear, no wahala. At de time de mouth of kalala de use bad eye luk ya head, no be person go tell you who to call to cum pay ransom for ya head make dem for no go sell ya kidneys. Some pipo de wey dem mind strong pass ajaokuta steel, so tey, if bodi nor phone dem, dia brain nor go eva connect. Anyways, how far my pipo, and how una de? Hope area bam even dou rice nor stew? Anyways, na for us to de console each oda bicos na de same one-chance canoe all of us de for on top middle of de sea.

All of us no say naija hard die, and pipo brain don open to do bad bad tins. To even make mata worse kpakpa, de police and oda security agencies na criminal in uniform plus gun join. All of us no how many criminals for awa areas wey las las land zone, dem wear Olokpa uniform with gun join. Wetin you go hia from dia mouth be say”we don change”. How? Lion go just tell you say him don turn vegetarian and goats go just carri belif, just laik dat? Who dos dat?

E be laik say de Olokpa pipo as in dia Ogas wey de on top, don begin worri how criminals and cultists full de Police. E also be laik say de Ogas dem don de shine dem eyes on how dem take de recruit pipo enta but las las dem go still enta as long as de criminal get kuza to tro arand plus say him get beta level wey fit use fone to do de connect. Dis na wia politicians for get pawa. All dia political thugs na eida Olokpa, Civil Defense Corps or Vigilante. Dis not mean say na all of dem be criminals or cultists oooo! De mata just be say, na one bad pikin for good family de draw dem leg cum outside.

I rememba one of my childhood friend wey tell me say, e go hard for Police not to de collect atara. Wen l ask am why, him tell me say de very day him land police college as recruit, de gateman tell am say him ticket to pass de gate na egunje. Him tell me say him pay as him see oda fellow recruits de pay. Wetin be de message of dat tin wey happen for de police college so?

Related News

Anyways, de rison l de make all dis example since na to carri us enta wia l de go. All of us no say kontri no good no more, but kontri hard ooooo!!! So, normal area boys don graduate to eida armed robber or kidnappers. Wetin l even de yan sef? I mean to say Kidnappers as armed robbery na for learners wey nor get experience or cultists wey broke. Kidnapping na big bizness nawadays as politicians and almost all de big mens dem de inside de bizness. Apart from Evans de kidnapper, all de ones dem catch de show for television be laik who get HIV-AIDS. Hunger wan kpai dem. Some go tell you how many years of experience dem get for kidnapping plus some kind big kuza dia victims don pay, yet dem be laik skeleton. Dis one show say na criminal bizness wey don take him time to settle down with us. De rison l de yan laik dis na bicos of de last kidnapping for Lagos wey burst and nine of dem kpai for de place from police bullets as two de on de run but still kolet bullet join. De mata about de kidnapping nor shock me, dat police nack nine of de kidnappers die no kukuma shock me, abi na de two wey kolet bullet wound take gbese? Whoosai. De real koko for de mata be say, de kidnappers de produce and act film for nollywood. Yes oh, na dat one be de shocker inside all dis. Na lesson to all of us to take learn say as Boko Haram don de every wia for naija now, na so kidnappers don de every profession and bizness. Na for lawyas, doktors, enginias, market pipo or na politicians wey be de grand patrons? Dis na to let us no say, ya broda or family members, friends or religious family fit arrange ya kidnapping just to kolet kuza from you.

De quesion wey suppose de worri us now be say, how we fit take de no all dis kidnappers wey de pretend with us as beta pipo? Una even nor say many traditional rulers don becum de heads of most of dis kidnapping cartel? So dia for how or wia we all wan for even start to solve dis mata? De mata don bad reach say, even who arrange ya kidnapping go join pipo de luk for you and many naim de volunteer to carri de ransom kuza go give him gang members. How we wan take solve dis wahala? Wia we wan from start kpakpa? De mata be laik person wey tif ya kuza de helep you to find am, dat nor be person wey pray for elephant to fly laik lekeleke?

De one wey de worri my mind now be say, na how we wan take stop dis kidnapping from dis Kain beta bizness wey e be? Wetin gofment fit do to put fear for pipo mind so dat dem nor go de involve for kidnapping? All of us nor say gofment put for law say, any house wey gofment no say na for kidnapping, na to destroy de house. No wahala, but wat about communities wey some traditional rulers with dia boys don give dia forests to dis kidnappers? Wetin make dis kidnappers de hard to no be say, anybodi fit de inside no mata ya profession or ya education. Ya pastor or Imam or Native doktor fit arrange ya kidnapping and kolet him kuza kule kule. As for de film pipo, make una start to over shine una eyes oooo!!! Even from de way oloshos take invade de film bizness as actors and producers suppose prepare una mind for worse tins to cum. But dis one wey kidnappers don bicum actors and producers so, make we not cum hia one day say film wey all de celebrities de, say de producer with some of him crew don kidnap dem.