My pipo, wetin person ear nor go hia for dis awa kontri? Tins do dabaru reach say, everi bodi heart plus mind be like Mill Mascara mask for wrestling of dose days. Pipo don see am as part of dem culture nawadays to becum pretenders. Nor be as you de see person nawadays, na so de person true true be. De mata de cum make me rememba agbepo for Benin City dose days. Una don forget? Bicos of de indomie generation, agbepo na pipo wey de use iron drum take pack shit from latrin for nite wey pipo shit put. Dem de always wia mask make even dem wife nor no say na dem work be dat. De job carri shame so tey, even truck-pusher dose days get respect and level pass dem. So not surprise say person wey him job for nite na agbepo, fit be watch day for morning till evening for ya primary or secondary school, and wen you go hia dem de condemn agbepo work you go tink say dem can neva fit do dat kain job. Anyways, how una de and hope una don find oda ways to survive for dis bulaba-pro max? Las las de ones wey survive fit chop breakfast. I welcum una to anoda wik of Tatafo Series. Only dat dis time we waka far small go Lagos go gada tori of pipo wey police delete for dia own kain agbepo work.
Any time l de yan on mata wey konsan bad tins laik dis, l de always talk am say Edo plus Delta States combine de learn work, but pipo wey chop belefu go de use dia energy take de oppress my own. Shebi fawol yansh don open as beta briz blow am so? Na tif wey him DNA cum dis world with ogbonge stamp from Oga Devil fit get cross-mind rob you on Monday and go cum still tell you say him go de cum ya house at exactly de same time for one wik and him nor go miss am. Na dose kain tifs full Lagos. Na police fear dem pass Lagosians just as LASMAN fear areas boys protest pass soja bullet. If you not undastand, l pray make you not eva witness wetin l just de yan so. Tori wey reach me be say, Lagos don discover how dis kidnappers and tifs dem de take operate nawadays. Dem de study different profession wey pipo laik and get respect for and gbam! Laik trap wey catch rabbit, dem don enta de profession, begin use am as mask to take remove pipo and police eyes from dia bodi. Weda e de work or dem fit succeed just laik dat? Ova succeed de worri dem joor. If dem wia de mask of ya bizness, you go cum see say you wey tink say you be CEO, na just ordinary boy-boy brain you get take de run ya bizness since. E shock you? Be calming down till de real tori land.
Many of us use awa ear hia many tins and use awa eyes see say Lagos style of kidnapping don enta anoda level if you wan luk as kidnapping be for other states. If we remove north from dis whole kidnapping mata as far as de style of kidnapping take de, we go see say, for South, kidnapping na family and church business if we not wan add gofment inside. Even Police don no now say, for every ten kidnapping, friends, family members, or church people hand must to de inside, but Lagos own don carri chair wey dem carve laik throne enta de kidnapping bizness. Dem don use style style enta Nollywood as producer and actor so dat pipo no go eva fit use goat eye take de luk dem. Una hia about one kidnapper wey police delete with him gang pipo? Him name na Henry Odenigbo. Him nickname na billionaire as him get kuza reach. Dem say him name popular for joint pass do-ri-me song as him sabi use kuza to take do notice-me. I even hia reach say, him film company na Ason-Rich Movie Production and de company popular die for Asaba and Lagos and say, no club wey neva feel him presence as far as kuza de konsan. Una go even shock to no say him don do many ogbonge film wey oyinbo de call block-busta. Dem say awa guy kuza long so tey, him nickname come be billionaire movie-maker.
De tori be say, dis Henry take him time to study everi tin about film bizness so dat everi bodi go fit nack chest talk say, dem no wen him take start. Na from dat level him cum begin de use style style de bring him gang members enta de film bizness before dem cum begin de kidnap rich pipo, use part of de kuza to buy equipment, get office and de live laik bing boys. As de kidnapping bizness de grow, na so him name de grow as billionaire movie maker until hand cum meet am with him gang pipo. We get parable wey yan say everi day na for de tif, but na one day for de owner to catch de tif. Make una nor mistake my yanings to mean say na only Lagos tif tif pipo or kidnappers de oooo!!! I only mean to yan say true true na Centre of Excellence as na dia police don for kpai kidnappers wey wia mask of pipo wey de do film.
As de mata do be so,everi bodi gat cap focus, so dat awa eyes fit see dose wey wia mask among us so dat kidnappers and tif tif pipo nor fit de use awa legit hustle take de do bad tins. Dis advice na also for oda profession, bicos, as mata de so, many san san don mix wella with garri. If you say you neva feel am for mouth, naim be say waka go still long die. If una nor want police to de use film pipo to take shine, all de association gats cap beta brain to take de do follow up on dia members everi time so dat evil pipo nor go get time plant dia evil seeds inside awa land wey we take de hustle. Las las na make awa legit hustle pay naim all of us de. Nagode!

