Our Fada wey dey heaven, make you no gree make pepos use de cutlas wey we take our money buy for dem take am kill us in Jesu Kristi name, Amen.
Dis today, we beg Baba God make our enemy no know road take come near where we dey. If yu like, say amen but as for me, I don alredy say big AMEN.
Dis tory na the tory wey concine one man wey say him dey work for DSS. De man na de landlord of one house wey dey for Mission Road. De house па по 53. No be say nahim be de original landlord bikos na de time wey him papa yamutu him come take over. We tank God say de house sef neva enter maket.
Una see dis house, de place na where disease dey do meeting. De pepos wey dey de area don complain taya but dis oga DSS man no dey listen just bikos him dey always use him work take dey threaten dem. Him even talk say nobodi go fit do am anitin as far say him be DSS man.
Bikos pepo dey fear am, dem come write petishion to Oredo Council to complain about de way disease dey comot from de compound. Na dat petishion we see wey make us go see de place for our own eye.
Oga, de place na eyesore. More dan one thousand pepos nahim dey stay for de house wey no even get latrin (toilet) and bafroom (bathroom). If una see de kind fly wey dey de place, na difrent kolor and size. As for de rats, de place na dia headkuata. When we try talk to de Landlord, dem tell us say make we no just worry oursef sake of say him no go mind us. Still yet, we go look for am more dan five times bifor we kome put am for paper. Na like dis de tory take come out on de 12th of July 2024.
Una sabi say de stone wey percin see no dey blind percin. Dat tory say cholera don stat to dey kpai pepo for some part of dis our Obodo Naija.
Along Mission Road for de back of de house wey be no 53, e for gud make de chair of Oredo Council go visit de place. No be de tin wey man fit talk finis for dis paper. De room wey dey de house no pass eight (8), but de pepos wey dey deer pass five hundred. Pepo wey dey de area don taya to dey complain but de landlord no send. De kind rats way dey patrol for dis backyard for korokoro aftunun big pass porcupine and na so dem dey run from house to house. Even de kind fly wey dey deer fit transport disease go more than ten miles to deposit dia kargo for anoda compound.
As una dey read dis tory so, de kind tins wey dey shelle for dis house backyard don pass be careful. Anytime wey rain take fall, de tins wey erosion water dey kary come out from dat backyard na helele. Seeing na believing. If you no put nose mask make you no go there sha. You fit be victim. Even IDP camp na oga for where dis house dey.
By de time we finis our investigation we come know say na all de beggars wey dey siddon for front of Catholic Church and Baptist Church dey stay for de house.
De petishion wey de pepos for de area write to Oredo Council Health Office, dem say: “We wish to bring to your notice the impending health hazard within the Mission Road and Idahosa Street axis of Benin City. If not immediately checked and curtailed there is the possibility of upsurge of deadly diseases.”
De petishion come describe de house as “no 53 which has been a very terrible nuisance to the people of the area”.
Even sef de letta still put join am say: “Though the occupants do not even know or understand the degree of the health hazard they are constituting to the environment, the owner of the property, as a bully, is also paying deaf ears to the entreaties of the neighbours.”
Finally dem come write say: “However, as law-abiding citizens, we consider it necessary to draw your attention to this menace instead of taking drastic actions by ourselves. Consequently, we implore you to, as a matter of urgency, dispatch your health officials to visit this ugly site without further delay. Please be informed that there is a limit we can bear as far as this afore-stated issue is concerned.”
You see, de tito of de letta na “Impending explosion of health hazard” and na four pepos put hand for de petishion.
My pepos, na so de mata take start o! E be like say tru tru health pepo go de place dats why de lanlord dey vex. De tru word be say na de pepo wey Oredo Council employ for Health sopose to dey do dis kind work. But bikos Naija don get as e be, dem come dey do like NEPA pepos. Even if dem waka go see place like dis 53 Mission Road, dem go troway face after dem don get small change for pocket. Dem no care weda pepo go die or not bikos of dia aksion. If you waka go Lagos Street, Iguisi for 2nd Ibiwe, Iwegie axis and even Igun Street, dem boku well well.
So therefor, if man pikin come see dis kind tins and him come talk, dem go dey vex. So tay, even dey plan how dem go take kpai de percin wey talk am out. Dis kind tin no good at all. No be say man dey fear dis DSS man o; even if him be Presido, him no be God not to talk of say na even small boy for de DSS office.
I even hear say him don dey waka about to see who go show am my house so dat him go come deal with me for writing about de condition of him house. I day wait for am.
De resin why I bring dis mata come out na to make pepo know say some pepo wey be officers for uniform work dey think say dem fit do and undo without anybodi chalenging dem. Dat na big lie. E no fit hapun.
How many pepo foma President Goodluck Jonathan kpai for dis kontry sake of say dem de yab am, abi de present Presido, Jagaban? Dis mata sef no be yabis but de tru position wey dey ground for evrybodi to see.
We even hear say one charity group donate money for dis landlord DSS man make him take do latrin but whoside, him chop de money. Now him dey threaten to kpai de percin wey expose de condishion of him compound. If una hear de money wey him dey collect from dis beggars, una go shock and begin to wonder why him no fit clean him own compound. We for just live dis mata for Mathias if no be de tin wey hapun on de 13th of August 2024.
As I dey for my broda party dis man come meet me for de place wey I siddon with my brodas. Na for there him come say make I follow am bet if him no fit “show” me. Him boast say hìm go kpái me for dis town and him go make me know say him be DSS man. I just look am laugh. A boaster can do but a little. De tin wey man wan do go dey for inside him mind. We shall see.