My kwesion befor l rand up las wik yanis on wetin konsan awa creative industry mata, many kwesions show up and naim we take do homework wait dis week yaning. Incase una forget de kwesions, na dem be dis. Na only late Brigadier Samuel Ogbemudia undastand wetin culture be and how e take important to us? Why oda gofment nor gree invest in awa culture? Awa indomie pikins dem fit nak dia chest any wia talk and defend awa culture from awa native food, folklores, dresses, native tongue, festivals, and how all dis take connect to wetin oyinbos de call morals, values? We ready to grow awa culture or to destroy am kpatakpata?
Atink l fit rememba una de kwesions. If anyone de wey l miss, naim be say na as tins on tins take de, naim de kwesions nor too de. So dia for, make l de my de on de kwesions wey l fit rememba. How una de my pipo? How hustle and area? Make una nor worri, baba God wey fit let us enter balablu, na de same baba God go make us also fit survive bulaba pro max activation mode.
If una rison awa creative industry mata well well, una go see say de mata be as e get. All de artists for Edo State don ova try to make sure say awa culture neva wipe comot Kpatakpata. Dis awa people and awa artists, if not for dia love for awa culture, with de way many gofment don take abandon de art council, reach wey we no go even no if we still get culture.
Late Brigadier Samuel Ogbemudia, na ogbonge man wey him brain at dat time don de see de future. Una rememba say, Afta de Naija civil war, him be wan even gada all de Igbo engineer to come Bendel come begin use dem skills to take develop Bendel State and Naija but Gowon and many pipo dat time cum de fia say na anoda plan Ogbemudia get so dem stop de skills center. Make we nor forget say awa Ogbemudia na from Igbanke and dem de yan like Igbo so, na one kain corna eye dem take de rison de idea wey him suggest. Anyways l nor need to wahala una brain on all de tins Ogbemudia do for both Edo and Delta. All de tins be like wetin person who see tomorrow do.
Ogbemudia make awa culture get level wen him be gofnor. Dat time,artists wey him employ from all de local gofment area de proud to carri dia difrent culture mata for head. If una rememba, wetin dem no Bendel State for dat time, na Bendel numba one for evritin. True true, na dat spirit still de Edo and Delta states bodi till today. Edo State art council don turn to extra luggage nawadays. All de remaining workers out of workers wey no reach 20, de retire and afta dat wetin wan happen to art council wey no get level like befor? How we fit make awa indomie pikins dem undastand awa history wey don happen befor, wey happen afta and even now? If awa art council nor be as e suppose be how even us fit rememba or no awa culture?
As for why oda gofment afta Ogbemudia nor send awa culture plus art council, dat one kpakpa shock me. Bicos, na all de tins wey Ogbemudia do for ground all of us still de see, like de secretariat for Sapele road, airport, stadium, games village plus many oda tins. My kwesion now be say, why oda gofment like to use wetin oyinbo de call consultants to de handle cultural events and nor send art council unless if na to shake yansh and dance only one particular Benin dance? Why oda gofment use strong mind to turn art council to only de shake yansh for gofment public?
As l de yan so, many pipo go say weda l nor de see cultural tins wey de happen for awa state or weda l don blind? Wetin l de yan be say cultural event and cultural plan nor be de same. Cultural plan na wetin de for ground about awa culture for Edo State and how to spread am throughout de state and to de advance am evri time so dat pipo nor go forget de history of dia pipo. Oyinbo say culture de dynamic and na dat one go also make de cultural plan also de sidon afta sometime to check if awa culture de for line.
Today all of us de see as pipo de abuse culture during marriage ceremony, during burial, during culture day for schools. I no say many pipo go de vex wen dem de see as pipo from awa state and oda states de abuse awa culture, but make we nor forget say, snake say no be who use atalikpokpo nack him head die naim kill am, say na de person wey first shout say “see snake see snake” naim kill am. If we true true wan to solve all dis wahala, we all need to like sidon and ask awa self how we wan take make sure say awa culture nor die? Gofment need to go check de Act wey Ogbemudia do to take set up de Art Council and use touch light to luk am wella, so dat we go no wia we for miss am & wia dis rain for start to beat us. Las las we go get sense by force if we nor want yahoo plus and cultism to bicom awa culture. Anyways, me l don yan my own. We go see nex wik as baba God must giv us strength to kontinu to survive dis Bulaba pro max.