Anoda day don land and usual we must to celebrate awasef say, even doo say na Bulaba pro max moto all of us as masses enter so for jorney to wia we neva still no. All we no be say, nor mata how de moto do for main road, las las we fit still reach wia we de go. As de tin de even do us now, we all don learn to de nod awa head like obaikpo (red neck lizard) wey land for ground from coconut tree, as no bodi clap hand for am. How una de? Make we not give up as life don almost be like case of “poor man de suffer, monkey de work baboon de chop”. Make baba God nor let awa water wey we wan drink for river run pass us.
If una rison awa yanings for sometime now, una go rememba say, na how we wan take cross mind to make awa film industry, oda parts of de creative industry divelop, naim we de jawjaw like ketekete wey de chew leaf since. We not go rest until we succeed bicos if we fail, awa pikins wey de now plus de ones wey dem neva born, nor go eva forgive us say, we no do anytin but follow any wia belle face for matas like dis. If una even rememba kpakpa, we even take awa small pawa to take yan like pipo wey de for National Assembly on top awa Arts Council during Brigadier Samuel Ogbemudia time and ida gofment wey nor too send dem at all. We neva yan on dat mata finish as TATAFO even hia say dis gofment de plan to employ plenti pipo enta de Arts Council make e for be as e first be dat time for Ogbemudia time. We don shine awa eyes plus borrow searchlight join to see weda e go true true fit happen bifor dis gofment lef office.
Anyways, dose of us wey de for film no say, dis gofment de put Kuza evri year for some time now, make we take de organise Edo State International Film Festival(ESIFF) and cum add anoda one for pipo wey de act for stage, de dance koshora dance plus anytin wey get to do with de stage mata. Dis year go make am de second time wey gofment do am say make e get head. Una go tink say na efizi l de or just wan to jawjaw like ketekete wey de chop leaf. Whosai, na true l de yan and de name of de koshora festival na ENINA Theater Festival. I go cum back to yan on wen dis koshora festival wan take place and for wia, but de kwesion we need to ask awasef now be say, wetin dis ENINA Theatre Festival de all about and how Edo State pipo wan take benefit from am.
If una rememba my yanings on Arts Council tori wey we write two times and yet we neva even scratch am at all, we go see say na de same tin dis ENINA Theatre Festival wan still helep one kain to achieve. I go broke am down for all of us to undastand. Many of us de hia pipo talk about koshor and anytime we see pipo wey wia de same cloth, carry drums, egogo, ukuse and flute de play and dance, we go jus nak awa chest call dem koshora pipo wey de dance koshor. If we use adult eyes luk am, dem koret small but koshor big pass like dat as e mean de ripe wey tie all of us togeda as one pipo, wey go make de pipo only de see wetin go unite dem as one pipo with dia own forbidden laws and many many tins. Na wen anoda person com force him own on top ya own kasala go com burst wey go com make pipo de hala as we all for Naija do wen de oyinbos dem com skata de rope wey tie us togeda as one pipo.
As e be so, we all grow up to de hia “one Nigeria”, afta many years we no com de hia am again, bicos, all of awa koshor difrent as you de cross from border to border inside Naija. We as Naija pipo com use awa brain take describe all awa difrent koshor as “unity in diversity”. Wetin dis ogbonge grama mean be say, even doo awa koshor difrent, we all still de kampe inside am. Na dis make gofment to make sure say apart from say we get national troupe wia all the koshor of Naija pipo de, evri state must to get Arts and Culture to de do all de grama, while Arts Council go de do all de performance of de many koshor wey de inside de many states wey de Naija. If you luk am wella, de old gofment wey separate de ministry of Arts and Culture from de Arts Council thru out Naija get why. So ENINA Theatre Festival na to use dia full force to add levels to de Arts Council and de Ministry of Arts and Culture as dia kontribushon to make sure say awa koshor nor die, and we fit inject am put inside awa youths dem blood.
If gofment true true w de Arts Council back to how e suppose be, ENINA Theatre Festival na wetin dem fit use to take select among all de many koshora groups wey de com from difrent local gofment areas of Edo State, who dem fit employ for Arts Council as almost de remaining ones dia don de retire. So atink we don see some part of wia dis ENINA Theater Festival de important to us for Edo State, apart from to teach us about awa history as awa pipo take de dose days, how dem take get respect for oda pipo, how we take nor de do bad tins as e must bicom adulation bodi. Anyways, me l don yan and do my own. If we nor want awa kontri to fall upon us, make we cross mind de celebrate all awa koshora festivals plus to helep Arts Council to be as e first be dose days to helep de Ministry of Arts and Culture to spread Edo Culture to awa pipo and to de world thru performance. Las las we all go learn say pipo without koshor be like moto without driver. Edototheworld!!!