We get popula pareble wey yan say, na wetin person neva use him eyes see be wetin neva happen befor. De pareble also make me to rememba as we de yan say, na bicos trees near each oda make pipo tink say monkey too sabi jump. All dis pareble nor be for noting as e get why l de use dem for hia. As black pipo, e get anytin wey de inside us wey go make us no de beta tin to do, but de tin go de shuk us inside to de do de bad bad tins? I de yan like dis bicos l no say black pipo brain de catch fire but e be like say awa brain wey de catch fire so, naim de destroy yaghanyaghan so. Una sure say, de tin wey de cause awa problem as black pipo so, no be inside awa soil e de? Odawise, why all dis pipo wey nor let Tina work for awa kontri, or do de right tin like not to beat traffic light, use de law to favour demselves and plenti odas, but wen de land akata, dem go begin do de propro tins like who booze clear for him eyes? Anyways, how una de? How una de survive awa bulaba pro max? Not to worry, anytin wey go up for Naija must surely go up as usual, but las las, na who cross-mind fit chest all de wahala.
I no say many pipo wey neva undastand say culture for all ova de world na bizness and na also anoda wey to take brainwash pipo brains to com begin behave like who him brain de do ova-heating on mata wey nor konsan wetin who brainwash dem want. If una rememba or take una mind go back to de Olden days wen dis kpotokis use brain enta us, give us bible, tell awa ancestors say dia religion na juju, befor dem kolobi evri tins we get go dia kontri, tell me wetin dem us after guns to take konfuse us? Na CULTURE, but dia own culture. Since dat time till today, dis oyinbos no liv dis dia system of to de use culture to achieve pipo tins. My kwesion now be say, Wetin make us nor fit undastand awa own culture, re-arrange am wella so dat we fit package am wella and begin seller to dis oyinbos dem? Why we nor fit study all dis Oyinbos teknik and also use am to place dia own chess game with dem as de Chinese, Indians, Japanese do and still de do? Why awa own difrent? Na who do us?
Culture na big business and many kontri wey no get minerals like crude oil, diamonds, gold and plenti odas, use dia brain to take de sell dia culture as tourism for odas and com de use dis kuza to develop dia kontri. Tell me which people apart from Asian and Indians wey near us for culture, plus say we com even get all de mineral resources join? Make awa case no com be lie who too no book and too much book com make am de kolo. Why we, with awa difrent plenti culture, com be like person wey him hands dirty but com begin use spit de wash am wen him sidon inside river? Bad gofment from bad politicians, wey bad pipo force put for gofment, be de real koko why awa kontri be as e get and wen you luk arand oda kontris for Africa, na de same tif tif kind of bad pipo de dia gofment. Who do us so, who do us like dis?
As e be so, de mata be like say na wen awa heads gada koret, and we com agree to put de right pipo for gofment, we all go begin see de plenti goodies wey baba God take bless us. Dis mata nor be wetin dem de pray put bicos, all de kontris, like Afghanistan and plenti odas wey sabi pray and kabash naim poor pass for de world plus com get tif tif pipo for gofment. You don eva see person wey get pikins and wives dem to take care of but com begin tif de food wey him suppose take feed dem and de chop am alone? Na exactly wetin dis awa gofment de do us. Gofment na awa papa we suppose giv us dia pikins food to chop, good house to sleep put, beta hospital and many many goodies wey papa de plan for him pikins, but awa own com be de opposite. Na who do us like dis? Who do us so?
If una travel go rand many kontris wey dia politicians brain de inside dia heads, una mouth go open down like who hot porridge burn him mouth. De shocktalizashon na say, many of dis kontris so, nor bilif in prayers or to de kabash like awa kontri but dem get good mind to plan beta tins for dem pipo. As de mata don com de so, awa gofment need to de copy de pipo wey kolonize us so dat we go fit develop. Una even no say Arts Council of England get wetin dem call Global Talent wey de give visa to pipo wey get talent for arts and culture mata plus say dem com de even add grants join? Na so e de for many kontris wey dia gofment brain de inside dem heads. All dis grants or free kuza so, na to encourage dia citizens to kontinu to de promote dia culture inside and outside dia kontri. Why Naija gofment, both State and Federal no de give grants but loan to film and culture pipo to promote awa culture de way e suppose be to oda kontris? Why e be say kontris wey get beta kuza de give grants abi free kuza to dem citizens for difrent areas to develop dia kontris but Naija gofment de give loans with rules wey pass JAMB and Visa mata combined? Anyways, make we de rison dis mata l just start to yan so on who do us like dis as far as how to use culture take make plenti kuza, attract tourists and begin giv grants to pipo wey get talents for awa kontri to do film, promote culture plus oda creative areas. But sha, I nor no why l still de get small shinkele hope say we fit still see small breakfast from gofment hand las las. How e wan happen, me l nor no. If you ask me, na who l go ask?