Thank you Baba God as you make us see today again.You do well for our bodi. No be say we beta pass de pepos wey don yamutu long long time ago but bikos you dey show us merci dats why we still dey brit your free air. For de kind kondishion wey we dey so for dis our Naija, if to say dis free air you give us say dem dey buy am, plenti boku pepo for don kpeme. Baba you do well.
If percin do sometin wey e good, de propa tin na to praise am or even sef nack am beta award so dat oda pepos go dey wan copy am. Even kpakpa, de percin go get mind take do more.
Na so life sopose be. But insted of make pepo praise man pikin wey do good, some of dem go dey take dia mouth dey talk nonsense, even dey call am name wey no be e own.
De rezin why dis tory comot today na bikos of de kind tins wey de owner of one place wey dey around NTA Benin take make de pepos for de area happy well well.
Bifor bifor Uwa Street for betwin ICE Road and TV Road na one kind road wey pepo no de fit pass anytime from 6pm for evening bikos of all dose fine fine boys wey no dey like to take eye see telefone abi purse for oda pepo hand. I know say you sabi de tin wey I dey yan. Even moto no dey fit pass de place.
All dose ones don change kpatakpa. De place be like London street for night now all bikos of de way de man wey get one big place wey dem dey call DEEPEND don tanda gidigba for de place. As dis Deepend dey for Uwa na so e also burst out for Nosayaba Street also for betwin ICE Road and TV Road.
For deese two roads, light no dey kwench for 24 hours. Pepos, landlords and tenants no dey like to go sleep again bikos de area dey be like afternoon even for night as customers dey always full de place from Monday to Sunday evriday. We hear say na one baba wey be Akate get de place. De man try sha.
No be only dat one dey make pepo happy ooh. For dis area, any young man and woman wey say him no get job, na lie him talk or him na lazy percin wey no fit do any work. Even old papa and mama dem get opportuniti to work for dis place.
De Akate man make sure say all young pikins for de area get work first bifor any other person from outside de area. Just like him put light from end to end of two streets, na so dem give work to every percin wey no get work from end to end of de two streets. Security jabrata 24/7.
Abeg make una give dis man 5 gbosa!
True to God in heaven, man pikin neva even meet dis man at all at all but de tory wey man hear sopose make pepo tink twice. Even gofment pepo wey get bizness place wey big pass dis Deepend no fit do like dis. Instead, dem go comot go far go bring pepos to come work when dem know say pepo dey around wey no get work.
For ezampo, if you put eye for de uniform of all de pepos wey dey work for Oshiomhole police, bifor you go see Edo pikin name, e go be like two out of five hundred.
At times man pikin dey wonder wetin do us dis kind tins. You go leave your own broda make him dey suffa and comot go buy bulta and bread take beg anoda percin make him come enjoy for your place. No be say your broda say him no wan work ooh. If na man abi na woman do us dis kind tin, Holy Ghost fire!
As if de tins wey dis Deepend Akate man do neva satisfy de man, him come put interlock for de road so dat pepos and vehicles fit dey go about like railway. I hear say de man name na Festus Osaretin Isibor.
On top of all deeze, de bobo come put borehole for de pepos of de area so dat dem no go dey suffa for water.
Now, make una tell me de tins wey dis Akate, Festus Isibor, neva do to make pepo wey dey around am dey happy.
Number 1:
Him put light for de two streets wey dey shine and make de whole area bright. Even if na pin abi needo fall for ground for night, you go see am sharp sharp.
Number 2:
Dis Oga Festus Osaretin Isibor put all de young men and women plus inkluding dem papa and mama for work and him dey pay dem salary evri two-two weeks.
Number 3:
Oga Isibor also rent house near de working place put some workers apart from say him put interlock block take do dia road so dat potopoto no go dey disturb dem. Na gofment sopose do all deeze tins for pepos but dis Akate abi Americana man no send at all.
Number 4:
Him give dem free water bikos of de public borehole wey him dig put for de compound of de Odionwere of the area.
Number 5:
Security pepos full everywhere. Since Deepend come tanda for de area, de place don cool and kam. No more tory of fone snatching abi purse snatching. Even sef, police no dey even borda to dey come patrol de area again except say dem wan come ask if anything dey for de boys. Everybodi kukuma sabi say if policeman visit you for your house, him go ask you wetin you keep for am, and if na you go visit am de kuestion go be wetin you bring for am.
Anyhow, dem tell us say dem be our friend even though de NPF mean No Permanent Friend. Well, make we leave dat mata for Matias make we face de one wey dey ground.
Oga Akate, abi Amerikana wey get Deepend, we salute you. Abeg make you kontinue your good work. Baba God go bless you.
If you de pawa dey my hand, you go get CFR – Commander of the Federal Republic – but until dat time come, take five gbosa.


