Make una gada join me to thank Baba God for de mercy wey him dey give us to make us see today. Many don yamutu and many sef no fit comot for one place sake of say dem no well. Even sef plenti boku dey for hospito wey no fit dey talk abi na to eat. For dis rezin, we sopose thank Baba God for de tins Him don dey do for us, de tins wey Him dey do now, plus de tins wey him still wan do. Baba thank you.

Okay now. Una sabi say elestion for Govunor of dis Obodo Edo State go soon shelle. Dis no be news again but de kind tins wey don dey hapun don dey make us surprice plus fear. Tru to God in heaven, breeze don dey blow fowl yansh. Pepos wey dey tink say pet politis na moi-moi, make dem rezin well well bifor dem enter join de game bikos de show no eazy at all at all. Anibodi wey know say him get small skeletin for inside him cupboard no sopose joim politis sake of say anything wey dem think say dem hide must to come open.

For dis Edo 2024, tory don jabrata. We don dey hear for Tuke Tuke say one of de pepos wey wan do Govunor no even know how to speak oyibo bikos him no go gramar school. Some say dis bobo strogo well well to fit pass school cert. But bifor nko? If man no strogo to pass ezam, wetin him go strogo do? Dis na yawa talk. As for say him no sabi yan for oyibo, if na true talk, dat one get as e be.

Dem even talk am say na bikos of dis wahala him no de like to dey wan near all dose oga wey dam dey call John Alice. We hear say him no wan go fall him hand for where dem dey bikos him fit no understand dia kuestion wey dem go take big big oyibo ask am. Na by force ?

Thank God say dis Oga kukuma nack good reply to dose pepos wey dey akuse am say him no sabi oyibo. Make una wait oh! Na gramar we wan chop? All de gramar wey we don day hear bifor, where e karry us go? Make we pluck leaf to take cover de shit wey dey near cherry tree make we karry de chery go chop.

Anoda tory be say anoda bobo too go get percin wey go dey talk de oyibo wey him dey speak to de pepos wey dey for hìm own local government council area bikos him come know book sotay him no fit speak him own language again. Na wa oo! De tory no end like dat sha. Did bobo no fit sleep him village make witches and wizards no kill am.

Politis, politis, poli-tis. If all deese tory na true, den,walala brekete for ground sha. Make una ja break.

De no. 3 perin tory be say him no get wife for house, dearfour him по go fit do Govunor. De kuestion be say, dis one dey for our konstitushon? Since him get pikins, nahìm be say him go also fit manage de state, abi?

Related News

Anyhow sha, na dia wahala. De big headache wey plenti boku pepos for Edo State get now be dat of de Govunor wey wan komot for office now. Na only Baba God know how him go take do de magic. Too many kuestion dey ground wey dis wake and see Oga need to settle sharp sharp bifor 21st of September this year. De way him go take ansa nahim go detamin if him party go win dis election.

De talk for town be say GGO, as dem dey call am, don put leg for plenti pepo toes. De tin wey pepo no understand be say, why Oga Obaseki no dey talk him own side of de tory? Court say make Shaibu come back to him office. Government come go court say na appeal and stay of execution. No how no how, one policeman die for de mata. Oba market women don start to dey run from pillar to post while poor pepos no dey fit go hospito again.

All deese tory wan too much just bikos of elekshon. Pepo wey dey Edo State na one kind pepo wey like peace, no be say dem dey fear war. Today, Ogbane don turn to Ofone.

One tin wey all of us sopose to know be say ororo no dey fade; Oba no dey go transfer.

As for de Oga Professor wey day in charge of de elekshon, make him be careful. Pepos dey talk am say some percin forge PVC and up till now we never hear from Professor weda na true or not. Dat kind quiet no good at all, abi Professor dey take cunny cunny dey call us fools? Because we dey hear say silent na de best ansa wey dem dey give fool.

Judiciary don dey wait for de time wey dem go get dia own palliative abi na egunje? No how no how, afuta dis elekshon, na court go finally declare de winner. By de time dat one hapun, we go see if Nigeria go burn down!

Osho Baba, how now? You don get summons abi you go settle out of court? Go apologise o because dat statement pass be careful. Una dooh.

Me I no dey support any party, dat no mean say I no go vote. If you dey vex for dis write-up, sorry. Truth na smoke wey no dey fit hide – a defiant smoke. But sha, if you vex well well, you fit shoot me make l kpai, I go ready to go meet Baba God.