Many of us nor de waste time to yan say dis film toff or dat film nor toff and e get why. If una carri una mind go back to how awa films dem take start, weda na televishon or na home-video, we go still rememba dat all of dem always de toff. Na from dis toff televishon and home-video, many actors for make dia names and com bicom popular. Na wetin com happen wen we all wan to de do film like America films?

Na evri time l de yan say, na pipo we no dia korshor wella, fit do wonder wey go make pipo open dem mouth like who wan chop hot yam. If l de yan say, awa wahala start from wen we all for naija no com de see anytin good about awa korshor and com even de shame for am join like person wey born didiri pikin and com de hide am from pipo. How baba god go take him time take bless us and awa kontri, and we go jus gada, sidon like say we hold family meeting put, no com see anytin good about awa korshor and we still com tink say evritin go work like abracadabra for us? Wia dat Kain tin for de happen?

To develop any kontri nor hard like awa gofment de yan us evri day, abi China, Malaysia, Japan, India get two heads for dia neck? I rememba wen l be small pikin and de go skool; dat time so, dem de teach us awa different langwage for skool, but today notin like dat. If naija get pawa today to com colonize America, we tink say America go fit still grow or kontinu to develop? If we force dem to trowey dem god and com begin serve Ogun, Orumila, Sango, Olokun and many many oda gods we get, we tink say dem brain nor no nok? Na Wetin de Oyinbos dem do us. Dem force us to reject awa identity and com de worship dem gods and speak dem langwage. De mata even bad reach so tey, dem com make am by force to get credit for English befor we fit enta univarsity. Dat one not be error?

My own way to take solve dis wahala nor pass say make gofment pump kuza put for film pipo bizness to take de do films we go de show us and awa pikins dem who Ogun, Sango, Orumila, Olokun be and how dem take de gidigba for to protect all awa villages wey make up naija. Gofment fit still tell film pipo say, de kuza to do dis film also mean say dem fit do films wey go show de awa plenti supermen dem like all de warriors we make awa community get respect for oda community hand plus de Oyinbos dem. Make una nor forget say as we get plenti warriors for men dem, na so we get plenti wonder-women like Queen Idia, Queen Amina and odas. My kweshon be say, apart from de old skool pipo wey no dis history, how many of awa indomie pikins no all dis? If una go check comic books plus films for cinema, una go de see Spider-Man, Incredible Hulk, Wonder Woman, Superman, Flash and many many odas wey no eva exist but wey oyinbo use dem brain to creat.

Related News

For Oyinbos to creat dem Superman and all dose yamayama tins dem call all dose funny funny names show say, dem need heros to de luk up to for pawa to fit do or invent tins. For naija, we get surplus heros but oyinbos nor let us us awa brain to creat dem for awa selves. Oyinbos make sure say dem konfuse awa brain so dat we nor go fit de tin wella like human being, oda wise, why we nor fit de write awa own comic books with all de tins Ogun, Sango, Olokun, Orumila and plenti odas don do and still de do? Why e be say na only de tins Oyinbos tell us we belif pass wetin we de see among awa selves and wetin awa ancestors don do and still de do? Wetin de rong with awa brain and na who do us like dis?

Me still belif say gofment fit still solve awa problems. Dem fit make any langwage we undastand and Pidgin English konpozril for to enta univarsity for naija. Gofment fit make am by force for us to de watch only 40% of oyinbo tins like dia news but make sure say evritin we de do na all about awa korshor, starting from using awa pidgin langwage as a must to take enta univarsity and otormatic employment to who graduate from Pidgin English and any oda of awa langwage from univarsity. Dis na wia awa films and gofment need to com show dem pawa. Abi we all don forget say na film Koran and Bible oyinbos dem take put us wia we de sotey, we don de bind awa own history, ancestors band call dem demon. De mata nor shock you? Aw amata be like who carri bilala and com de flog awa own shadow say naim be awa problem. Dat one nor be original mental case?

I still de talk am any wia l get de chance to yan am, dat na gofment hand naim evritin de. Una neva see all de Chinese and Indian engineers plus doctors say, dem nor sabi spoke English? Yet dem sabi dem work die. Nor be dem langwage dem take de teach dem selves biology, chemistry, mathematics and plenti oda subjects? What about Russian and French people? Nor be de say tin? Why awa own come different and bad so tey,we no fit change awa own destiny? Na who tie us?

One tin l no be say, if gofment want all awa pipo to improve and get dat identity, make gofment cross-mind to invest Kuza for film pipo to de do films, documentaries on evritin wey gat do with awa korshor and us. Also, gofment suppose creat sometin like Netflix for film pipo for naija to take de sell awa films. With ova 200 million populashon and com add oda Africa kontris join, naim be say Africa don wake up be dat. Nor be big ogbonge error for us for naija to de use awa kuza to take watch films for Netflix, Prime and oda marketing platforms whereas, na small kuza gofment go take do like Netflix for film pipo and also de give dem grants to take de make films put for dia. How we naija film pipo, de giant of Africa go use awa kuza take do film and com put dem for YouTube de disturb pipo lives de beg dem to subscribe to dem YouTube? Dat nor be error? For naija to change and develop like China we must by awa selves through gofment use film take sell awa korshor to awa selves, Africa and de rest of de world with awa own kind of Netflix marketing platform to take de sell dem and make kuza. Anyways, how una de and hope say we go use awa tongue take count awa teeth for de gofnor elections wey de com so? If de Bulaba pro max nor de good for ya body, you suppose do de right tin and vote wella, bicos las las we fit still chop dat breakfast for afternoon. I salute una oooo!!!