Many kontri de wey nor get crude oil like Naija or oda minerals wey de bring ogbonge kuza to dia kontri, but yet dem get kuza pass all dis kontris wey get crude oil. Nor be suffer wan kpai us for Naija so, even doo we get crude oil? One kontri de wey dem de call Venezuela, and many kontris for inside Arab wey get surplus crude oil but de suffer like person wey de konplain say water de hungry am, and yet him siddon inside river. Dat one nor be juju?
Ok nau, wot about kontris wey get plenti koshor and many many nashora tins wey baba God give dem like wetin oyinbos de call water-fall (dat is river wey de fall from on top of inside moutain com down) plus many many odas? Wetin we do fit do with awa zoo even doo wild animals surplus arand us? Apart from to kill all dis animals and roast dem for fire as animal, which oda tins we de use dem for? Baba god bless us with evri tins to take make enough kuza to take de jollificate and make oshelenge-oshele for evri wia we de. De tin nor shock una say, inside wia food surplus jabrata, all of us still de hungry? Nor be curse oooo, na as we take rison awa own mata be dat.
All of us de shat and say kontri no good anymore, bicos awa refinery dem nor de work, dat na true, but awa oda nashora gifts from baba god nor de work? Wot about awa koshor wey we get? Wetin we don fit use dem take do apart from to yeye dem as we don take tif and dabaru awa own crude oil wey baba god take bless us? Evri year, awa gofment de spend billions trowey for awa pipo to go pick sand from Israel and water from Galilee as odas de go stone devil for Mecca as if de devil wey de inside naija wia helmet and use odeshi for bodi. Una don see wia devil de stone devil? I no get any wahala with de rilijons wey but de devils in human clothes wey de use dis rilijons to cover up. Anyways, de area wey konsan agbero for any moto park, na to load dia buses or to carri loads. So dia for, my own konsan for dis rilijons mata be say, na de pipo KOSHOR wey dem don arrange to de kain level wey e be say, pipo de plan to travel by dat time of evri year to dose kontris. Na de power of koshor be dat.
We get rilijons? Yes. We get koshor? Dem jabrata. We make dis koshora get level and also make am popula to awa pipo and oda pipo for de rest of de world, capital NO. Na dia awa wahala for get pawa like Mike Tyson to de give us ogbonge wahala. Evri bodi plus Oyinbos dem no say awa koshor ova surplus and na so dem de enta person eye die! Make una just imagine say de whole world no say Igue festival, Ekaba festival plus odas de happen evri year for Edo State and na also de period for de pipo wey attend am to remove all de spirishua yamayam from dia bodi and to face anoda year with good spirit for dem bodi, say dem nor go de book dem visa down like who de hit akara in de moni to take settle akamu for dem belle? This one l de yan so about awa koshor for naija, nor be for only Edo State oooo! Wen l see koshor plus Ekpo (wey oyinbos de call masquerade) for Igboland, Yorubaland, Hausa/Fulaniland, Igbiras, Delta & Rvers areas, l de shocktalized like person hot akamu.
Afta Tatafo plenti jawjawing with many pipo, we com see say de tin wey make awa koshor nor de giv us kuza like international bizness be say, awa gofment nor gree spend kuza to make all de roads to dis places, nor gree spend kuza to take build all de shrines in a way wey nor go change as de shrine suppose be, plus no general abatisment for all dis awa festivals dem. Naija de do films pass oda pipo and kontris for Africa and many oyinbo kontris, but why all dis film only make naija popular for ritual money, blood sucking by winches, Boko Haram and many many oda tins? De rison be say, na wetin awa films package giv dem be dat. If gofment cross mind to keep billions wey dem de waste and odas de tif to giv film pipo as free kuza wey oyinbo de call grants to de do films wey de promote all koshors weda big or small ones for dia films plus documentaries, and com set up awa own kain Netflix wey go de buy, sell and promote, all dis films from naija and oda kontris for Africa, befor una blink eye like labalaba feda, awa koshor don bicom popular all ova de world. My kwesion be say, why gofment of naija nor gree see de kuza wey dia investment inside koshor mata fit being to naija? Why pipo from oda kontris nor go fit com pick awa sand for spirishua freedom and to use katapot to take shoot all dia wahala for naija? Anyways, l don yan my own and go kontinu to yan as long as l still get pawa to do am. Las las, weda e be as e get for now, we must to shopulate breakfast.