Many of us use awa kro kro eyes see america wonder for Ogbe Satdium wen Rema land Benin like Eagle wey don see wia him from grow befor him begin fly. Pipo wey skelewu reach wia Rema for hold de whole world standstill for Edo State, see wetin dem neva see befor. As for me, l nor de miss show for Ogbe Satdium from wen Benson and Hedges de organise music konsat, to wen Mandators plus MAJEK FASHEK and Ras Kimono de perform for Benin. But dis Rema show, de way pipo de shim gum bodi, even sardine beta pass. If you trowey sand go up, e nor go see wia land except for pipo head. My pipo, true true, Edo get wetin to sell to de world plus wetin to use to take sell am.
I don de talk am de com since gedegedegbeu say, koshor na wetin person fit sell to any oda person any wia for dis world without wahala. We nor need to undastand each oda langwage bifor we fit undastand koshor or de tins wey de helep us to no Wetin be koshor and how to make sure say we no lose-guard trowey am like dorti. Rema na intanashona star wey don shine rand de world com land for awa great Benin Kingdom. All of us de hia for inside Benin de use awa ear and eyes de see de kind ways wey bad belle pipo take try to make pipo wey nor de Benin, to begin see Rema homecoming show like wetin no fit shele. Una wey de dia no say, level nor only fail de bad belle pipo alone ooo, but even dia bad belle run lib dem go de dance for Rema Ozeba song. E no shock you?
Dis Rema music show wey dem call homecoming suppose open all awa eyes to com see say, awa state plus Nigeria just sidon on top kuza but com begin waste am like tap water wey de rush trowey for notin. Many kontris for obodo oyinbo side, nor get crude oil or even land to take plant anytin, but dem de collect kuza to take de divelop dia kontris, make am fine well well so tey, we go com tif awa knotri kuza wey we profit from crude oil to go spend for dis kontris. With all de koshor wey we get for dis awa kontri, we not suppose to de suffer like person wey sidon inside river but begin use spit to take wash him hand wey dorti. Dat one nor get as e bi?
Anyways, Rema, Shalipopi and many other musicians for Edo State na koshora products wey we fit sell to any part of de word and use am to de raise kuza for de state and de pipo wey de inside. Bifor now, we get big musicians like Waziri, Sir Victor Uwaifo, Akaba man, Osayomre Joseph, Adamosa, Omochicobe, Sir Ugiagbe, Ukodo, and so many wey ebi say, if l say make l put dia names for hia, next two wiks l neva finish. Dis na koshora goods wey we as a state nor fit market wella, odawise dem for popula like Don Williams, Dolly Parton and many oyinbo musicians dem wey dem de call Country Musician like awa own native musicians. Wetin we need to learn and do, na to no how and wen to no say we don get koshora goods for sale to de rest of de world.
Wen l de shat since say we need to make sure say we make awa Arts Council get level for current ways of tins, some pipo even de laugh me and de tell me say l de wail like John de Baptist for bible. I no worri sha, but my own na to see say all dis koshora goods for awa music and film, for awa wood carvings and moulding of pots, wood combs and many tins we suppose package to sell to de rest of de world nor go be like awa great great grandfathers bronzes wey nor get level dat time but com get levels nawadays in billions of kuza. All of us no say we get one kain koshor wey oda pipo nor fit see and trowey eyes just like dat. We don pass de level of “wao, dat’s a good job! Wao, you go go places! Wao, you ova get talent die!”. De time we de nowadays, na to learn wish pipo or kontris wia we fit sell awa koshor, also learn how we fit improve awa koshor in one kain way to fit take make de rest of de world choke put for awa mata and awa talents.
All of us no say, any pipo wey dia koshor nor get strong legs for ground like iroko tree, na only time e go take bifor agbakara go swallow am. Baba god wey give us awa own kain koshor no say na wetin we fit use take many plenti kuza pass crude oil and diamonds. All we need to do na to oganize awa brain to de direshon of de bizness of how to market and sell awa koshora goods thru de Arts Council and gofment. Yes ooo!!! Gofment. Till today, from gedegedegbeu till date, l neva see any kontri wey dia gofment hand nor de inside de marketing and selling of koshora goods. At least, dis Rema homecoming na eye-opener for all of us. Infact, wetin gofment nor fit do, dos not exist.
So dia for, all my yanings since na to let us no say, wetin we all de find yakayaka de go Sokoto, de inside awa sokoto, plus say kpakpa, dat gofment na de jet bomber and pilot to catapult awa koshor from hia to de rest of de world. Wetin we need na wetin oyinbo de call KONSISTENSI. Oh yes! Na konsistensi we need to fit take let de rest of de world de plan dia vacation to com Edo State to see and buy awa koshora goods. If gofment no fit do am for us, who will? See una nex wik and happy fuel increase. If l hear “same to you!”