My pipo, una new guy for area don land oooo! Make l first trowey salut ooo, before l come kukuma by myself and for myself go press spoil by mistake. But sha oooo, for inside my mind, l no say una must catch my salut wella.

We all don nor say life be like action film and comedy wey dem mix wella like egusi and Ogbomo soup to take sentence pounded yam into our belle. My pipo, we no say times hard and money de yab man pikin, but las las no forget say to make person laugh nowadays till water begin fall comot from him eye, no be like to soak bread for inside tea to take wak correct fried egg at all.

Remember say, to collect wotowoto no de too far from people wey no wan take advice but wan turn celebrity overnite. Those wey don try am and come see am say na tortoise yansh dem go put hand, how market? By now una suppose don use una tongue count una teeth to nor say, no be as dem take de call papa, naim dem take de call mama.

Weda una like am or not, water must don pass garri be dat, but again, e neva too late to shine your okpolor eyes, open your brain and come learn how to take start from de beginning first before you fit come become celebrity.

Wait ooo, na who don see mecanik wey open workshop without say him no learn de work? No be to press spoil be dat? Na better customer him go be to Olokpa and jail be dat. Las las fowl yansh go still open and craze person wey family de hide go run comot do de dance Kokoma for inside market.

To press spoil sweet wella, but no go let pipo come de laff you as you by yourself go fall your own hand for market ooo! Evrybodi wan popular like Chief Ajaz, Sam Loco, Nosa Rex, Eunice Omoregie, Charles Inojie but nor wan pay de price to learn from school of be apprentice to who don nack many years of experience for de work. How person go think say him fit succeed like dat?

Related News

My broda, my sista, you must to learn the work of actor wey de act barman, boss or good person role or pipo wey de gather do all de work before pipo fit Sidon look am for cinema or any where pipo fit watch film. If you want pipo de shout una name anywhere dem see una, work de oooo!!! Soup wey sweet, na money arrange am, abi una nor wan know dat part?

To press spoil naim sweet and easy pass to press good and all of us nor dat. Person fit use many years to build house but na less than one hour e go take to dabaru am. I nor say money fit yab man pikin to take go school or become apprentice but na to first start something. At all at all naim be winch na. Na to first sidon tell yourself say “na dis thing l wan do” and if you serious put e must get head. No be one day Oba Ozolua take fight plenty war and come popular. Na time, training and strong mind him take do am. To become an ogbonge person for anything you wan do no be one day job at all.

No go do pass yourself come go press spoil because, las las na you go still suffer am. By de way, na how you wan take become Oga, wen you nor wan serve your master wey wan teach you work? Even Jesus learn work and na so him disciples too. Abi una don see you no work wey money de fall on top him lap? If you wan make am for film, na to hang your over sabi for your yard before you come join other pipo. Na your character go first make pipo notice you. I no mean eye service as many de do and even pipo wey de do eye service no de ever last for dis film work because okro seed wey strong must show face inside soup like bone wey kolobi under pot of soup, na time e go take buy e must shook person for throat.

If una de watch film una no de shock say, before spit wey dem put for ground dry, na once one new actor go just de show for all films? Una no still de shock say na once too even some of de popular actor no de show for film again? Dis na why apprenticeship wey go fit open your eye to come become ogbonge professional de important. If you no learn the work wella, e must to purge you later like otoro. My pipo, carpenter wey no learn work finish before him go open big workshop must to become police customer, because na everyday him go de spoil pipo work and before you roll your okpolo eye finish, him don comot from market.

We go nack una anoda tori by next week on anoda mata wey go helep our film bizness. Make una no forget say, na where papa de advice pikin, na from dia, pikin wey him papa don kaput, for de learn, odawise, na wotowoto him go de collect every time.