Our house wey tanda gidigba for Osadebe Avenue go soon dey avalabo for rent. Dis na bikos Obaseki wey be de tenant don dey take idea dey pack him things comot small small. De people wey get de house talk say dem no go gree make him stay put for de house again sake of say na only four years dem be dey give de house for rent, but as him come beg make de landlords let am stay anoda four years, dem kukuma gree… after all, eight years no be forever. Na for eye de time long. Before you sabi know, de eight years don complit. Na so we see am.

De wahala wey de people wey get di house dey face now be say, plenti persons don dey beg to hire de house even if de landlords never know who go fit pay de house rent and maintain the whole compound. De oga wey dey there befor don dey talk say na person wey no get house to stay for Benin suppose to get the house. Dis oga think am say na de way we sopose treat our visitor be dat. But the megad wey dey keep de house tell de landlords say make dem reason well well before dem give de house to person wey dey come from far place bikos him fit carry some tins wey dem sopose to take make de compound fine go him place if him dey go home. Dem also dey talk say dis kind person fit no do anything for de house until him don build him own finish for de village wey him dey from come. Hmm!

But dis man agent talk say dat one na lie bikos him know dis person. Him say na de man wey sabi well well. Some persons wey dey fight make dem no give de house to dis our man wey sabi talk say dat na wayo talk. Dem say, dis tennant wey dey comot for de house don spoil plenti things for the house wey him no fit repair plus many many people wey him be wan kill with suffer suffer. Why him want make dis man wey sabi be de new tennant na bikos of say, nobody go fit do am anything again by de time him comot for de house. Dat na to say, de new tennant go cover up all de mago mago wey shelle when him be de tennant. As him never comot finish for the house, fear no go let anybody talk to am.

Bifor nko? Who wan try abi you no know say the oga wey dey dat house before get imunity wey nobody fit commot for him body till him pack comot from de Osadebe Avenue?

We also hear say de second person wey dey fight to enter dat house be like say him strong also. Our Amebo hear say na de ground papa of de people wey get de house dey support am sake of say him want make de person come help am do something for Benin City. Therefore, instead of make him dey come from village make him kukuma rent dat house even if na for the first four years before we go dey talk of weda de work go finish for four years or not. De wahala wey dis second person dey face now be say na de same village him and the first person from come. If na money be de issue, dees two person get am jabrata and de person wey support dem no be yeye person.

De other person wey dey struggle to enter dat Osadebe building na so so grammar dat one dey speak. No be say him no fit pay de house rent but him backbone no strong at all and bikos him backbone no strong like de first two persons, de owners of de house fit no consider am at all. Dis na bikos, should in case him do anything bad, who dem go report am to?

Related News

Since na for Benin City here him dey stay, son of the soil wey Benin people dey call ‘Omoto’ or ‘Ovbie Eseserese’, him fit stay for him house instead of wasting money for house rent. Anoda wahala for this person na de society we him dey. I mean de club wey wan send am message. No be say de club members no plenti but dem just newly form am. People never too sabi dem like dat. However, since na de same rope dem take tie all of dem togeda, mugu fit fall for guy man. Na where two elephants dey fight and dey get opportunity take shine after de grass don uproot.

Make una also look dis word wey one tuke-tuke driver talk. E be like say me go put my leg for dis talk sha. De driver say instead make we allow only de landlords of de house put tennant for de house, make every body kukuma choose de person wey go fit take proper care of the whole compound. Him say e better make we vote. De time wey we dey so plus wetin dey shelle now, de kuestion be say – how many people go wan go vote with empty belle? Man pikin wey never see chop put for belle go fit go stay for inside sun sake of say him wan vote for person to enter de house wey dey for Osadebe Street? After you even manage go vote finish, as soon him become tennant proper, you wey suffer go vote for am no go even fit near an not to talk of weda him go wan helep you for anything.

Even sef our vote no mean say him fit win bikos de elesion wey we dey do for dis our kontri na yawa. Before de elesion start sef de result don ready. No be de numba of people wey vote dey make person win. Na how your konesion be dey make person win. If no be so, de court people go announce dia own result. Dats why people dey talk say instead of wastin people time for vote mata, make gofment kukuma tell all de clubs abi na party dem dey call am, make dem take de name of de person dem choose for dia party go give high court ogas make dem by demsef choose one. If him no gree, Supreme Court go do selection for dem.

Like dis, people no go dey go do de voting wey no carry power again and gofment no go dey waste money for de elesion referee wey be INEC, especially dis INEC wey Alhaji Mamud be General Manager. If na dis General Manager wan still do referee for dis elesion wey dey come so, na him be say our court people still get plenti work to do wey go even make dem dey sleep for afternoon when dem dey talk the abracadabra. Teknicians still boku with dia technikal approch.

Tru Tru, ‘eleyi o kan mi’, dis no be my turn abi ‘emi lo kan?’. If your PVC still dey wit de referee, you fit go collect am. Make una no forget say everybody dey vex sake of say no food for belle.