Wahala nor de finish, so my pipo make una create time to enjoy. Even de person wey kpai Jesus first rest befor him delete himself. I no mean say na kpai go follow awa jollificate oooo, dat na wetin even baba God himself nor go ever sign. Happi new month to all of una plus say l congratulate una for wey we don fit play first half of de year and still ready to carry de go. If una neva still grab why l just de jollificate so, make una waka pass any mortuary and una go shock to see say dead body de arrive per second billing. Me l nor no about you sha, but for me, l lie down gidigba and twale baba God for de kain mercy wey him get for me to fit de kampe to de get pawa to de land hia to yan on tins.

If una luk arand una side nawadays, na small tin remain make pikins wey still de dem mama back self form dem own unions to take de fight wella for dem own right. If una rison dis mata, una go see say na wen pipo unite like rice and beans dem fit ashive anytin wey dem put dem mind. Afta all, we all no say na corpreshon naim make rice full pot, just laik garri wey rise full plate.If rice and garri fit corprete with dat kain unity, why pipo wey de do vidio nor fit corprete?

If una settle down to rison dis mata l de yan so, una go follo agree with me say, na pipo wey unite wella, naim gofment de fear and also respet. All of us de use awa eyes to see am as gofment de always shake laik barber chair, any time wey naija pipo unite to protest. De rison be say, unity de rimove fear from ya mind bicos you no say nor be only you de de fight or struggle. Even police and army nor de pray to face pipo wey corprete to fight for wetin dem bilif. Na who de fear die de die. Anybodi wey don cross mind and nor send anytin, nor de fear anytin, not even to kpai.

Na wetin nor fit make film pipo to unite? Dis tin l de yan so, nor jus be Wetin de happen for Edo State alone, na all over naija. If una use adult eye to luk dis mata, or use una church mind rison am join, una go see say na dis unity wey nor de among dis film pipo make gofment neva fit take dem serious. How pipo wey de do film to take show us say dis na bad tin and dat na good tin, nor cum fit no good or bad tin, dat one nor be juju? De mata be laik person wey say him na wey get plenti espirense, but you give am moto to drive to take test am, him cum de ask you wia dem de put the moto key to take start de moto. Dat one nor be bad market?

If una luk arand naija today, almost all de unions get one union wey de unite dem, laik de one for doktors, lawyas, akantants, even vocanizer kpakpa get one Union wey de control dem. Oya na, cum for film pipo own, una go see say many unions with different Presidents de control pipo wey de act. Wot of pipo wey direct film, Union pass one, producer nko? Dem even reach five. With all dis over plenti unions for one tin, na how dem wan take fit talk to gofment or any overseas business pipo for film mata and dem go take dem serious? Una even no say, gofment de laik unions wey nor de united, bicos dia konfushon na wetin de helep gofment to not take dem mata serious.

Related News

If awa Presido, Tinubu or all de state gofnors ananse today say dem wan share free kuza for film pipo today, naim be say dat kuza na to go back to treasury. No be bicos say gofment nor wan give dem de kuza, but how more dan one union go cum out to collect kuza for only one union? Now, make una ansa me for wetin l wan ask so. If you na gofment person or you de represent dos big big bizness companies, and dis kain mata of pipo wey you wan helep, nor cum de united laik rice wey de inside pot or even refuse to kollabo laik rice and beans, wetin you go fit do? Oyinbo say, na as we all take arrange awa bed for nite, na so we all go take lie down kulele on top am.

Dis mata fit nor make sense to una until una de wia dis film pipo de. If you wan undastand me wella, any time you no wan give film pipo kuza, just ananse for any place wey all film de say, make the president of pipo wey de produce, direct, act and all of dem de say make dem cum out to kolet kuza, and see if nor be Police Station dem go for settle de mata of “ do you know me? You be fake, who tell you say C.A.C nor register us?”

Na dis same konfushon make censors board troway face de kolet kuza from anybodi wey show dem say dem don regista for C.A.C. Even as dis mata don reach so, if craze pipo gada demselves go regista as “Association of Craze Pipo film Actors, producers, directors…”, dem go de censors board list. Una don de feel me for dis mata so? Ok na. Ansa me dis qwesion, who get censors board? Who giv dem pawa to de do all de tins dem de do? Which bank akant all de kuza dem de kolet de finally land? If you don get de ansa to all de qwesions, you go undastand say gofment nor send us. Dem de even enjoy de whole tin wen pipo nor de united and na exactly dis kain unity wey nor de so, tie wrapper for film pipo waist.

If film pipo want make gofment take dem serious, dem need to quick no say, any family wey nor unite, na strangers de finally share dem papa property. I hope with dis few points of mine, l no konfuse but konvins una say, any house wey de fandashon nor unite no fit wear roof.