Pipo wey sabi scata grama for any wia dem get any oportuniti no de waste time to first start dia yanings with say, “talk is cheap”. If una rison this “talk is cheap” with adult brain, una go see say na truth full inside de matter like calabash wey koret palm wine full reach mouth. If to say, awa mouth fit build houses and buy moto, evri person for get houses plus moto join, but life not easy like dat as, “talk is cheap” nor reach to build houses plus buy moto. Dis one only mean say, we must to follow follow awa talk talk with action so dat, pipo go nak chest talk say, na hia dat man fight and kpai instead of na hia dat man boast and gbese. But in all dis, las las, na wisdom we all need to take collabo with akara and akamu evri moni to take start awa daily hustle. How una de? How de protest for una area? How levels for awa pocket plus awa pots? How we de survive dis Bulaba pro max? Anyways, make sure say in evri tin, you nor kpai, delete or nor fit breath, bicos awa Presido must allow de poor masses to breath, init?

If una open una ears and eyes on how the film industry take start and grow to wia e don reach today, una go surprise to no say, almost all de states from Naija get de same tori. While de pipo from de grassroots wey de inside de creative industry mata, get dia own tori, de ones wey sabi book mata get dia own tori. Make we not forget say, even befor de oyinbos dem cum use cornicorni take enta awa land, tif awa culture, awa lives plus cum force us to accept dia own culture, we don de awa de wella. We don go far far for culture mata, for gorvament and hospital mata. Infact, we don ova divelop befor de oyinbos cum tif evri tin we get. But sha, nor be history l cum yam hia, l only just de want say make we use style take undastand how and wia awa creative industry from start.

For Edo State, de jorni of awa creative industry be like who de pick stones comot from Abakiliki rice. Na case of work hard befor jollificate. Even as oyinbos dem do us reach, dem true true tif evri tin wey dem hand fit grab, sell many of us like tolotolo for slave market, yes dem true true sorcid wella, but wetin dem nor fit kolet from us na de true culture wey de inside awa heade and awa hearts. Dat na wetin baba god don give and put inside us like salt and peppers wey don mix with beans to do akara. Notin fit remove or separate am. So as dem say dem don giv us freedom, like tif wey cum ya house to rob you, use ya adunga or stove take cook ya food inside ya house wak, and cum later tell you say bicos of god dem wan liv ya house cum bigin go, we all bigin dance and celebrate. As celebrations end, eyes clear, na so all of us bigin do wetin we sabi do, only dat oyinbos don use beta rope wey tight take tie Benin Empire, join Igbo, Yoruba and Hausa/Fulani say all of us na de same even doo na beta arrengee lie. Las las of us don de inside de mata like fish inside ororo. We don de manage awa wahala de go inside de konfushon, but all dis nor fit still remove de. Culture inside us. You nor need to go univasiti to no de difrence bitwin Edo culture and dat of Hausa. Na dis difrence so fit still manage to keep awa original culture inside de konfushon of de oyinbo culture wey we tie arand awa neck like who wan hang.

Related News

Anyways, make l yan about Edo creative industry small small. Na afta we don bigin rule awa self we cum bigin see say awa culture still de even doo de tin be as e cum take de, but we hold am tigh as dat na de only tin we fit true true call awa own. Evri tribe kontinu with dem plenti festivals, herbalist, artwork, dances and musik plus acting kpakpa. Make we nor forget say na thru musik we take de kip awa history or anytin wey we nor wan forget. Dia for, as gofment cum bigin drive awa culture moto, na so all of us de inside de follow follow. Brigadier Ogbemudia cum see as Asian kontri take arrengee dem culture display inside big hall and de tin fine. Him cum bigin get big big plans for awa own culture. As gofment build National Theatre for Lagos, na so him bigin build Cultura Centre with one ogbonge akitet wey him name be Demas Nwoko. Dat time so, cinema house full evri wia and awa current house of assembly na awa theatre hall wia pipo de watch stage acting befor later later Urhokpota hall cum join.

Na baba god plus awa ancestors go bless all de cultural troupes for dis awa kontri especially for Edo State. Dem nor fall awa hands as dem hold awa culture tight, even many for de stage play Lamgbodo wey Naija perform for FESTAC 77. Una go shock to no say de actors from Edo inside de play get Late Sam Loco Efe, Ben Okoeguale, plus plenti pipo l nor fit rememba dia names now plus awa Edo troupe pipo as the orchestra for de play. Atink una don de undastand how Edo take full evri wia for de creative bizness for naija say nor be by mistake? Anyways, l not sure say since Ogbemudia time say awa creative industry grow. Instead na fall e bigin fall cum down from since Ogbemudia time cum reach today. Na wia Ogbemudia build awa current abandon Cultural Centre reach e de till today, uncompleted by akitet Demas Nwoko as oda gofment refuse to allow am cumplit am. De once cumplit and popular Art Council with plenti buses like luxurious, coaster, mini and cars like station wagons plus cars for de directors of de Art Council, with plenti department like carving, sculpting, drawing/painting, documentation, musik band, acting, cultural dances of all tribes, academic journal wey dem de call Ivie, jus cum be like abandon widow wey first be wetin evribodi nor fit do without. Dat time so, Art Council na wetin gofment de call Parastatal just like as EBS, Observer, Bendel Line, Bendel Brewery and many more be dat time. If una luk Arts Council today, una go see say, na ordinary small unit e be now inside Ministry of Arts and Culture plus say de once big Arts Council of dose days, nor even reach 20 today and all of dem don old and retire almost evri 4 months as dia time of service don expire.

My quesion befor l rand up today so dat we fit kontinu next wik as part 2 of dis awa creative industry be say? Na only late Brigadier Samuel Ogbemudia undastand wetin culture be and how e take important to us? Why oda gofment nor gree invest in awa culture? Awa indomie pikins dem fit nak dia chest any wia talk and defend awa culture from awa native food, folklores, dresses, native tongue, festivals, and how all dis take connect to wetin oyinbos de call morals, values? We ready to grow awa culture or to destroy am Kpatakpata? Na all of dis we go gada yan nex wik. Make una put more holes for una belts and selefit una clothes as bulaba pro max don activate. Hunger fit beat and give una knock out, no wahala, but refuse to kpai ooooo!!! See una nex wik as we all hope dat las las we fit chop breakfast again. Hope not de kill oooo!!!