Thank God say all de wahala wey no let de Edo State chapter of the National Youth Council of Nigeria (NYCN) don finish and de pepos wey de office don dey setto down well well. Una do well ooooh.

Plenti boku tins dey wey una all must gada do for espesially dey yuts wey dey under una eyes for dis state. We beleve say una brodas and sistas wey dis una office sopose to dey work for also top stand dey make una sabi de kind tins wey dem want make una do for dem, even kpakpa dem go also know say una no be Baba God wey fit put solucion for all their mata.

Yes, me too gree say one person abi one regime no go fit ansa all issue so far na human beans wahala. Make una no mind dose people wey dey talk say no be one day dem take build Rome. Dem be wayo pepos. Na one day dem take build am. De day wey man pikin begin to operate de vision abi na idea wey him get, na dat day him finish work.

By dis time, I sabi say de oga wey dey carry de oda officers do de program of dis regime go don plan all de tins wey dem wan do for their time for office. So therefore na only two area we go like to make dem look well well so dat pepo go always remember dem and de tins wey dem do.

De numba one na de thing wey dey bring about katakata for this our base – if dem no fit get one hundred parcent, make dem try get half of de mark – de thing na job mata. Pepo wey go school say de mind wey no get de tins wey dey make am do work nahim be de place of work for devil. Abeg make una no laugh me bikos, I myself I no go skool. All de ones wey I dey talk so, na tiff I tiff am.

Like we dey talk before, dis present gofment of our yuts, de way I take see dem, na very intelligent and clever pepo wey know how their onions go fit make soup sweet. No be say I dey praise dem sha bikos one person no fit sabi everything. Too many of our pikins dem wey no get work for house. No be say dem no go unifacity but gofment no fit find place put dem. If one thousand commot for school na only about ten go fit get work. And some of dis ten people get work nor be bikos dem know book pass those wey dey for house but na bikos of de tin wey dey spoil dis our country. Nahim be say who you know. How poor man wey dey struggle to pay unifacity money go fit know de pamanet seketary for office? Tolototo and chicken na de same bird but na different club dem dey. Cockroach nor fit dance kokoma for day time because of fowl, no be say dem no know or like dance.

Thank God say de team leader of Edo chaputa of National Youth Council of Nigeria, Moses Agwinede Joseph, don tanda gidigba to make sure say our youth no just dey house dey sidion look. Him say de true word be say gofment no go fit give work for everybodi, therefore dats why de gofment of Obaseki come introduce for one ogbonge way where our pikins go dey do something instead of make dem dey stay for house doing nothing at all. Dis nahim dem dey call Edo Job kini kon. Dis Edo Job office na him be dey place wey our pikins dem fit go learn plenti boku work wey go fit make dem beta for life.

Oga Joseph Moses also talk say de pepos wey dey for dis regime of him council dem no get wahala at all at all with de youths wey dey for Edo, especially since dem come power. Him talk say na two areas dem dey handle very seriously now wey concine youth. Dis na cultism plus drug addiction.

Related News

According to dis NYCN chairman, dem don already dey kolabo with de oga kpatakpata for police and dat of sojas to carry mirror look how dem go fit work together to put final full stop for cult and drug mata. Dem don also put de mata before de people wey dey do drug mata wey dem dey call NDLEA.

No be only dat sha. De campain plus meeting to put mind together for how dis two mata go take stop don also dey shelle. No be only dis one dem don dey do, dis chairman come talk say even sef dem go soon start to dey train Edo youths for inside de compound of the Youth Council Secretariat when dem finish de job creation centre wey dem dey build. Him talk say because no be everybodi wey go unifacity sabi how to dey do application for work, one of de tins wey dem go dey teach pepo for this job creation centre wey dem dey build inside de secretarial na how to dey write application for different kind of work. Dis na another kolabo wey de council go do with Edo State gofment.

To make sure say dis plan work well well, de oga madam wey be acting oga for this Edo Jobs don ready gidigba to also do kolabo and join hand with dem. Him come talk say since the arrangee stat, de result na very good one. No be say dem go just dey siddon look, de officials of NYCN go also play their own part by de time de centre don fully dey ground for inside the secretatriat complex.

Cultism mata, dis youth chairman of Edo chapter no dey take de mata joke at all at all. Him and de other members of de council don dey do campain and dem talk say nothing go make dem stop until Edo State no go get cultist again. Everybodi sabi say dis na mata wey go difficult but since dis pepos don go beg de Commissioner of Police and Commander of the 4th Mechanized Brigade wey dey for Edo State, nahim be say dem fit succeed, so far de youths go listen to dem.

Oga Moses Joseph talk say Edo youths na people wey dey hear word, so therefore him beleve say dem go hear the things wey him dey tell dem, especially as dis job creation office go soon begin for inside de council complex.

Final final, him come beg de youths say for dis eleshon wey dey come so, make dem no let politician people use dem as agbero abi as pepo wey go cause katakata. Him come talk say no be say him no go support any protest so far de protest no be de kind wey people dey do because of their own wayo interest. If na correct protest wey concine de masses and de suffer suffer for pepos, dat kind one na beta protest. So far no be de one wey people go dey do gragra.

My people, una don hear from de mouth of de horse. But our pikins dey listen?