Na who nor no wetin leaves for bush fit do, de call am vegetable. Who nor no say leaves fit cure any sickness or even fit kpai person go de tink say na only for soup, or as wetin we fit take wak yam or plantain dat vegetable good for. No be able food l wan yan today, but l only de use de vegetable mata as example of say, nor be only for food baba God give us leaves. Una go soon no wetin make me start dis yanings like dis, but befor den, make l ask as usual, how una de? How una family plus work? Hope una de kampe? Anyways, no mata how tins tough reach, e nor go fit tough reach tortoise back bicos, even do we de bulaba pro max, las las l jus bilif say we fit chop breakfast. Dat na if e neva quick area boys gbese with awa breakfast.

Many of us we de sabi travel like mungo park, suppose fit undastand wetin l wan yan so bicos na wetin many of dat kain pipo don experience. Make we not forget say, cinema full abroad wella and na so dem like to de enta dia to watch film, like woman wey get appointments with doktor. For naija, pipo don grab cinema like ants with sugar. Many pipo de always de luk forward to wan go watch film for cinema everi wik. Now, l no say you go don de wonder say, wetin konsan cinema with wetin l wan yan so. Nor worry, you go soon undastand say dem be like tongue and teeth connect.

Pipo wey de do film go tell you say, na wahala to fit gada kuza to take go do film, as dem need to pay de actors, pay de pipo wey de gada to use difrent tools to take gada do de film, pay for all de tools wey dem wan take work de film, pay for food, transport and many yamayama tins wey fit giv you kasala. All dis tins l yan so, na de beginning of de whole wahala, as afta all dis, you wey get de film go cum begin wahala ya head on how you wan take sell de film or make ya kuza back. Apart from film as bizness, all of us no say na product wey popular naim pipo de rush. I rememba dat year for akada wen awa tishas de yan us say, na wen demand high like high-tension wire, naim de make supply long. Which is to say, na wetin popular and wey pipo no about, dem go de luk for to buy like who de find hot coffee to buy for harmattan morning.

Related News

My quesion always be say, why pipo wey de do film, go hustle to find kuza to do film and not eva tink of how dem wan take make am popular and to de hungry pipo like hot panded yam with hot bush-meat ogbono soup? Why film pipo de gbese from film festivals wey de dia domot and de ones for dem kontri plus de plenti plenti ones for abroad? Why dem de run from film festival like who de gbese from who de use cutlass or 2by2 de porshu person? Anyways, make una helep me rison dis mata one-kain one-kain, weda na bicos dem de fear film festival like LASTMA or dem be like who hold Bible and no open am bicos dem nor fit read, but nor no say na kuza full inside de Bible?

Film festival too ova work for film pipo, as e be like wia you go fit sidon and notice from de way pipo take de do to no weda ya film enta or not. And ma wia you fit still hia from pipo wetin dem nor like inside ya film or wia dem tink say you suppose konsetrate put. Film festival na wia fit make ya film popular. Na wia fit make you jam ogbonge film pipo wey de buy films and ya film fit just enta dia eyes like atarodo pepper, and na kuza mata don shele be dat. Wetin even make all dis film festival mata ova work be say, you fit gada actor plus de pipo wey de use tools to do de film, to do film wey be even one minute. Yes ooo!!! E shock you? Film festival short film de start from one minute to de point wey dem go cum give as de time for long film. Dis one mean say, na as ya pawa and kuza reach you fit take do film and send to film festival.

Nawadays, many film festivals de give kuza to de best films, give awards to film pipo, de even organize free training for difrent areas wey dem take de do film, and you go get time to take meet oda film pipo from difrent areas of ya state, kontri and arand de world. Now tell me, which networking pass dat one, or which awuff pass de free kuza wey ya film fit win? As film pipo, make we de make sure say we open awa eyes and awa ears to always take de no wia film festival wan to shele and at least send any of awa film go dia. Wen pikin de suck food from feeding bottle, him go tink say panded yam and egusi, or banga and starch na yeye, until wen him test am. As film pipo, make we de behave as Bible talk wen e say, make we make sure say we test all spirits. De spirit hia nor be kain-kain ooo, befor you go cum go finish mama Osakpolor root-kainkain say na me yan am so. Anyways, make we as film pipo take film festivals serious and las las na we go still gain am, as we nor get excuse nor to fit do any short film even with awa fone. Make we nor worri, l go yan all more about de film festival wey de awa backyards and how we fit gain am like who get free suya from Aboki. Wen we see nex wik, we go yan more. No kpai liv us, as all of us still need each other like eba and okro-soup.