Let us pray. Baba God, we don come again to gada tank you for making we see today. Evri tins you dey do for us bifor bifor, de tins you dey do for us now now, plus inkludin de one way you still plan to do for us, we tank you. De tins wey we know and de ones wey we no sabi, Baba God no let dem kill us in Jesus name, Ameeen oh!

Benin pepos dey talk say de stone wey percin see no dey fit blind him eye. But if you see am and you troway eye comot, na you sabi.

Oredo local gofment people get pepo wey dem dey pay salary for health mata. De dey waka well well for town weda na knowing and doing dem dey do for some place man pikin no fit talk.

Cholera wahala don start to dey kpai pepo for some part of dis our obodo Naija but for Benin City, bikos dem neva carry dead body go for hospito mortuary, nobodi don show koncine. By de time de tin go hapun, na dat time fire brigade aktion go stat. Along Mission Road for back of de house wey dey oposit Fidelity Bank, e for good make de chair of de council wit him pepo go visit de place. No be de tin wey man fit talk finis for dis paper.

For dis house wey we dey talk so, de room wey dey no pass eight but de pepos wey dey for deer pass four hundred. Dem no get toilet or bathroom. We even hear say some pepo don first write petishon to Oredo but notin hapun. Pepos wey dey de area don taya to dey talk and even de owner of de house no kukuma dey listen. De kind rats wey dey do patrol for aftunun for dis backyad big pass rabit and na so dem dey run from one house to de oda. De kind fly wey dey deer fit transport disease go more dan ten miles to deposit dia kago for anoda compound.

Bifor bifor health pepo dey go look pepo backyard to see if dem get latrin or not. Weda de latrin still guud or abi if na pit latrin, weda de hole don fuli. But today, fafafa-foul. Dem dey operate like some NEPA pepo who dey kolet egunje and troway eye for where metre sopose dey but e no dey. Na so dis health workers dey do now.

As una dey read dis tory so, de kind tins wey dey shelle for dis house backyard don pass be karefu. Any time wey rain take fall, de tins wey erosion water dey carry come out from dat backyard na helele. No be de kind tin persin dey write, as we say bifor. Seeing na beliving. No garante for any percin wey wan go see de place unless him put nose mask for face odawise de percin fit be de kasualty ezampo.

Anyhow anyhow, make de Commissioner for Health make sure say pepo for de ministry go see de place we dey talk so make dem come report back for am how de place be. Even IDP camp beta pass de place. By de time we investigation to take know de pepos wey dey stay deer, we come gada say na all dose beggar wey dey stay for front of the Catholic and Baptist Church.

Related News

For de petishon wey de area pepo first write, dem say, “We wish to bring to your notice the impending health hazard within the Mission Road and Idahosa Street axis of Benin City. If not immediately checked and curtailed, there is the possibility of upsurge of deadly diseases.” The petishon come describe de house as “No 51 which has been a very terrible nuisance to the people of the area”.

Even sef, de letter still put join am say, “Though the occupants do not even know or understand the degree of the health hazard they are constituting to the environment, the owner of the property is also paying deaf ears to the entreaties of the neighbourhood people.”

Finally, dem come write for de letter say, “However, as law-abiding citizens, we consider it necessary to draw your attention to this menace instead of taking drastic actions by ourselves. Consequently, we implore you to, as a matter of urgency, dispatch your health officials to visit this ugly site without further delay. Please be informed that there is a limit we can bear as far as this issue is concerned.”

Dis letter don pass one month wey dem send am go give dem for Oredo. De tito of de letter na “Impending explosion of health hazard” and four peops nahim put deer sinature for de body.

Na very bad tin to still dey see dis kind place for de centre of Benin. Plenti boku place dey for dis Benin wey worse pass dis Mission Road own wey we de yarn so.

Man pikin go do helep for health pepo for dis mata. If tru tru dem wan work, make dem carry waka go visit de backyard of de house wey dey for Lagos Street for Ring Road to de end of Iyaro. Make anoda group go for Second Ibiwe area, dem boku for dat side bifor dem go carry waka go to Iyekemosa side and Iriemila for dat ango. If dem fit do dis one, wahala no go dey. Sickness no know povati.

We tank dose pepos wey dey for Mission Road and Idahosa Street sake of say dem no take law for deer hand. Health pepos go know how to take deal wit all dose landlord and landlady wey value money pass dia life. Sometime sef, de landlord no go even dey stay for de house so far dem pay am de rent. As for the tenat, make gofment relokate dem to IDP kamp. Dem too plenti for dat place. Na so dem also plenti for oda place wey we talk so. Not until gofment do propa akshon, man pikin no go fit free from dis epidemik.

Una doooh!