Nna men! dis topic be as e get, but sha, as we na pikin of de soil, pikin wey dem beri him placenta for de same soil, shaking nor de, bicos, na wetin person neva see na him big for him eyes. On dis topic? we don break am down as e take concern Edo pipo and how awa folklore take carry heavy load for inside awa korshora filosofi. De Root of Edo Wisdom de inside him plenti folklores and e get wai.

For Edo State, espeshali for inside Benin Kingdom, tori no be jus for only night time wey grandmama and mamas dem de tell dem pikins jus to make dem sleep. In case you nor no, folklore na de engine room of awa korshor, naim be de book and history of evri record of wetin awa ancestors don do plenti yiars ago. Na inside all dis tori dem we de find de logic, de laws, and de way of life wey awa ancestors pass down to us. Edo filosofi no jus de for only books; e de for de air wey we de breathe, de songs wey we de sing, and de “Ibota” (evening tori) wey awa elders de yan us.

Inside Edo korshor, de tin Oyinbos de call symbolism de evri wia. Nothin de jus happen for nothin. If person yan you tori about “Igho” (kuza) or “Ehi” (person spirit double), dem de try to pass message about how life and de spirit world take de. Awa filosofi belif say de fisical world (Agbon) and de spirit world (Erimwin) de kolabo as in work hand-in-hand. De Symbolism of ‘Ehi’, wey be awa Spiritual Twin na one of de biggest part of Edo filosofi wey be part of awa korshor and wetin awa folklore de always yan us about. Every Edo person bilif say dem get spiritual twin wey de always de with baba stand God (Osanobua) to yan on dia behalf evri day. Oyes, na belif na, abi?

Inside awa folklore, naim you go hia tori about pipo wey jus de use dem pawa de struggle for dis life bicos dem no fit settle wit dia Ehi. De symbol hia be say, person destiny de for him hand, but dem must align wit dia spiritual self. Dis one de teach us say make we no just de run after fisical tins, but make we also get clean heart and spiritual balance. If ya Ehi say ‘Yes’, no man fit say ‘No’. Na so meni of awa folklore yan us, and wen you check meni oyinbo korshor, na so e still be.

If you look Edo art or listen to awa tori dem, you go see say animal symbols full dia yanghanyanghan. Leopard for Edo filosofi na king bicos na king e be for inside bush. So, de leopard mean pawa and lidaship. Wen folklore de yan us about de leopard, e de rim and us say, pawa and lidaship nor be to disturb yard with noise but to de in charge with ogbonge respect. Abi na de popular tortoise? You can fit yan any folklore without de tortoise na. Him na de symbol of wisdom and mago-mago (cunningness). If you luk awa folklore tori wella, you go see say de tortoise de always use him sense to cheat odas and dat na wai de end of him tori de always show say cheating, pride and greed de always lead to fall. De filosofi hia be say: Sense pass power, but wicked sense go always catch up wit you.

For inside awa Edo folklore, de Oba no be jus human being oooo! If you nor no, make you no. De Oba na symbol of de ancestors wey still de gallant and alive. Meni tori de always yan about how past Obas take get supernashora pawas to fit take protect de land and Empire.

Una fit nor grab de yanings, but dis symbolism de very deep. E show say Edo filosofi value Order and Authority. E show say we de awa de with de Oba and de throne so dat awa society no go scatter. De Oba na de link bitwin de pipo and de gods. So dia for, when tori yan about Oba, e dey remind us about who we be and wai we must twale and respect awa roots.

Edo pipo laik meni tribes for Naija and Africa no de use person wey get karacta take play. Dem value am die! Folklore de always yan about symbols like “Iselogbe” (success/celebration) and “Ukhure” (ancestral staff) to show say life na turn-by-turn.

Eni time you hia tori about de “Greedy Hunter” or de “Kind Orphan,” de message de always clear for de end bicos goodness get reward, and na so evil also get him own. This one na de foundation of Edo ethics. We no need police to tell us say make we no tif, de fear of de ancestors and de lessons from our folklore dey enough to keep person from all dis yamayama and jibiti. Eni ways, me l no say folklore na de bedrock of de korshora filosofi of evri tribe, for evri village wey make up Naija and Africa. Make we kontinu to de use folklore to take de teach awa pikins meni tins about moralities so dat wen dem grow dem go get human feelings and com value lives. Na society wey fail to yan morality through folklore to dem pikins wen dem small, de com suffer de bad tins wey cultism plus kidnapping de cause arand us. Who get ear make him take am take hia ooooo!